Yusuf Satia, actor death, biography, Kunle Afod and Nollywood dey mourn

Actor Yusuf Satia of Yoruba Nollywood don die and di industry. dey mourn di actor.

Im colleague, Kunle Afod, announce Satia death on im Instagram account on Wednesday, say di actor die on 21 July, 2020.

https://www.instagram.com/p/CC6Obeapqrf/

Yusuf Satia dey happun exactly four months afta Veteran Yoruba filmmaker and Nollywood actor, Gbenga Ajumoko bin die.

Veteran Nollywood Actor Gbolagade Akinpelu AKA Ogun Majek die about di same time last month, June 2020.

How di actor die neva dey dey clear. Satia become popular for im role in a Yoruba drama, Pam Pam.

Yusuf Satia don also be a fuji singer, according to tori and e get di time dem see am wit fuji legend, KWAM1, for various outings and shows.

Yusuf Satia Biography

Di late actor no be social media pesin as im last post for facebook na March 4 2013 wen he post countdown to my birthday.

Im full name na Yusuf Ojewale Satia and dem born for 9 March.

Yusuf Ojewale Satia grow for Lagos state, southwest Nigeria wia e attend primary and secondary school.

Afta im secondary school education, he gain admission to University of Lagos.

He also get certificate from di John Curtin College of Arts for Australia.

He die on di 21 of July and wetin cause im death neva dey clear.