Governor Fayemi add to Nigeria coronavirus stats afta e test positive to COVID-19

Kayode Fayemi, Governor of Ekiti State southwest Nigeria don test positive to coronavirus.

Govnor Fayemi wey be di Chairman Nigeria Governors Forum confam im status on Wednesday morning.

Di govnor of di state say im test positive afta di third Covid- 19 test im do on Tuesday.

He say im dey okay and im dey self isolate for house.

Im also don delegate serious work to im deputy but go continue to dey do normal work from house.

Ekiti get 86 confamed cases of coronavirus, 46 pipo don recover and 2 die wit di infection

Fayemi join list of governors of states like Ondo, Benue, Delta wey recently confirm dia Covid- 19 status.