Coronavirus stats: Donald Trump admit say US go ‘get worse before e go beta’

Donald Trump on US Coronavirus stats

Reuters

US President Donald Trump don sama warning say di coronavirus pandemic mata for US “go become worse before tin go begin beta”.

Oga Trump wey tok dis one as e resume im coronavirus briefing order everybody for America to wear face mask.

E tok say Face mask get work wey e dey do and e show say dem dey together.

Di president no wear face mask for di briefing as im no reason say e dey necessary.

Im aides don tell am say make e use anoda eye look di virus as cases of pipo wey dey infected dey rise for di US.

Di daily White House news conferences stop for April afta Oga Trump tok say if dem inject pipo wit disinfectant e go fit treat di virus.

Trump pivots on masks: ‘I’m getting used to the mask’
The British Broadcasting Corporation

Oga Trump tok say “If you no fit do social distancing, wear face mask”.

“Whether you like the mask or not, e get wey e dey do and e dey epp, we need everything we fit get.”

Di Presido wey dey always call Covid-19 di “China virus” – remove face mask from im pocket but e no wear am.

The president is facing an uphill climb to re-election in November against Democratic challenger, Joe Biden, according to opinion polls.

Oga Biden on Tuesday accuse Oga Trump say im fail Americans wit di way e take handle di pandemic. “E don leave una, E don leave dis kontri,” di former US vice-president tok.

Donald Trump mask

Reuters
America President Donald Trump use face mask for public for di first time

Sticking to discript

Analysis box by Anthony Zurcher, North America reporter

BBC

For di briefing, di medical experts wey dey always join for di meeting no dey.

He say make everybody for America continue to dye wash dia hands, do social distanceand dey serious wit dia hygiene.

For young Americans, e say make dem no go bar wey pipo to gada and avoid any indoor party wey pipo to full. E say make dem dey safe and smart.”

Oga Trump no like to dey wear face mask in front of tori pipo, e claim say some pipo dey wear mask as political statement against am. Recently tori pipo take one foto of wear im wear mask for di first time as e military hospital.

Why the US struggled with its reopening
The British Broadcasting Corporation

When dem ask am for di briefing why e change im mind on top face mask, Oga Trump tok say even health experts dey change dia minds.

For March, Dr Anthony Fauci, one of di doctors we dey lead di president’ coronavirus task force, and US Surgeon General Jerome Adams tok say pipo for US no need wear mask, say e no dey necessary.

Since at least April, di US Centers for Disease Control bin recommend say make Americans begin wear face mask for public.

Dr Fauci don begin argue now say make US authorities dey force pipo to wear mask for public, although Oga Trump don reject di suggestion say make White House issue national order for di mata.

For di briefing, di president continue to dey give hope say one di virus go “disappear”.

The lost six weeks when the US failed to control the virus
The British Broadcasting Corporation

He also claim say di pipo wey don die for di virus no plenty for America like other places for di world and dis no be true.

According to Johns Hopkins University, US mortality rate dey number 10 out of di 20 worst hit kontris.

United States record nearly 3.9 million Covid-19 cases and over 141,000 deaths – di highest for di world.