BBNaija season 5 housemates: Terry Waya billionaire son Kiddwaya na contestant for Big Brother Naija 2020 ‘Lockdown’ season

Tere Waya billionaire son na contestant for Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season.

Terseer Kiddwaya na 27 year-old self-employed man wey come from Benue State.

E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated.

E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling.

Di grand prize for di Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season na 85 million naira.

Arrogant and confident, na wetin Kiddwaya say im dey cari waka enta Big Brother House.

Being a Big Brother Naija season 5 Housemate don make Kiddwaya dey expect a better and crazier 2020.

E describe himself as confident, good looking, ambitious, a daredevil wey dey highly motivated.

“You never know wen your time don finish, so you fit as well go for am” Dat na Kiddwaya favourite words.

“Getting into health and fitness na im Kiddwaya say be im biggest achievement. I bin dey quite chubby, so I transform my bodi and I don dey consistent ever since.”