Nigeria schools resumption date and WAEC latest: Oyo state cancel third term and release calendar for reopening of classes

Student for classroom

Getty Images

Oyo state goment don release calendar to guide school resumption for di state.

Di Oyo State Executive Council for dia meeting on di 21st of July 2020, approve di academic calendar to guide resumption of schools and oda school educational activities for di state.

According to di approved calendar, Third Term 2019/2020 session don dey cancelled and promotion of students, for all affected classes, go now dey determined by First and Second Term Continuous Assessment.

Pry 6, JSS 3 and SSS 3 go proceed on holiday from 30th of July and resume for dia Examination as follows;

  • Basic Education Certificate Examination (BECE)- 10th to 18th August 2020
  • Competitive Entrance Examination into di Schools of Science- 19th August 2020
  • Placement/Screening Test to JSS1- 20th August 2020
  • Placement Test into Technical Colleges- 28th August 2020
  • SSS 3 go resume for dia Examination as soon as WAEC announce di date.

2020/21 academic session, according to di calendar wey di State Council approve na;

  • First Term- 21th September to 18th December 2020
  • Second Term- 11th January to 9th April 2021
  • Third Term- 3rd May to 30th July 2021

Di latest from Oyo state dey come as di five west African nations wey dey sit for di West African examination Council exams dey consider to shift di exams from August.

Di Minister of State for Education, Chukwuemeka Nwajiuba, bin yarn say di ministry don meet wit WAEC pipo dem on and dem don agree to consult wit four oda kontries to come up wit a new date for di exam.

Nigeria bin announce say student go write di August- September exam but later di education minister, Adamu Adamu bin do u-turn and announce say Nigerian student no go participate for di exam.

But on 13 July, goment bin release guideline wey all school gatz follow and implement before dem go open dia doors to school pikin dem.