Big Brother Naija Season 5 housemates reveal shocking tins about themselves on Day 2 of di show

Just two day afta di Big Brother Naija lockdown season 5 show start, some of di housemates don reveal some shocking tins about themselves wey di fans no know about.

Big Brother give di housemates task to tok about themselves, each of dem gatz tell dia fellow housemates something about themselves.

Some of di tins wey di housemates fit shock you.

  • 27 years Ka3na say she freeze nine of her embryos for South Africa.
  • Neo say im mama born am inside car.
  • Praise say im dey engaged and get pikin with im partner of four years. Im fiancé give am permission to “be bad wen im need to be bad”.

Im also say im bin dey three way relationship before. E dey datetwo girls at di same time and both of dem dey aware.

  • Kaisha say she no dey as confident as she look afta she struggle to take compliment from Prince.

https://www.youtube.com/watch?time_continue=96&v=6wf352n5rM0&feature=emb_logo

Dis season 20 housemates dey compete for di grand prize of N85 million naira,