Nigeria Senate ask Service Chiefs to step aside because of insecurity

Nigerian lawmakers don ask di top-top ogas dem for Army, Navy, Police, Air Force, Defence and Interior to vacate dia position.

Di Senate say di way soldiers for di kontri dey see pepper for jaguda pipo hand follow for di reason why di Service Chiefs suppose step aside.

“Di spirit of dis motion na say our armed forces dey try well-well no be small… We need to kontinu to encourage and provide for dem. Dem dey lay dia lives for all of us and e dey very sad say some of dem don abandon fight for war,” Senator Ali Ndume bin tok.

Di Lawmakers during dia meeting on 21 July, dey ask for new service chiefs to replace di ones wey dey dia now.

Why dis dey happun now?

Recently, di armed forces for Nigeria don face serious gbege for war front, so tey some soldiers don dey do u-turn, abandon dia work.

One lawmaker Sen Ahmad Lawan say di number of soldiers wey don comot reach about 200, and say dem go torchlight how dat kain tin take happun.

Di lawmakers say jaguda pipo don dey ambush soldiers wey dem position for border area.

Tori don comot of how Nigeria soldiers dey complain say dia ammunition no reach to fight di big-big ones wey militants dey carry. In anoda video wey trend for social media, one soldier say dem don tire to serve dia kontri.

Minute of Silence

Lawmakers say dem go observe one minute of silence for soldiers and also ask say make di federal goment do sharp-sharp to arrange better equipment for di armed forces dem.

Who be di service chiefs?

Air Marshal Sadique Abubakar

Dem born Air Marshal Sadique Abubakar on April 8, 1960, e be di current Chief of Air Staff of di Nigerian Airforce (NAF).

Na for July 13, 2015 President Muhammadu Buhari appoint am to di Chief of Air Staff position.

Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas

Dem born Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas on 27 September 1960.

Na on July 13, 2015 President Muhammadu Buhari appoint am to di position of Chief of Naval Staff.

Lt Gen Tukur Yusuf Buratai

Na since July 2015 President Muhammadu Buhari appoint Lt Gen Tukur Yusuf Buratai as di Chief of Army Staff of Nigeria.

Dem born am on 24 November 1960 for Biu, Borno state.

General Abayomi Olonisakin

President Muhammadu Buhari appoint General Abayomi Olonishakin since 13 July 2015 as di Chief of Defence staff.

Dem born am on 2 December 1961 for Ekiti state.