Some of di major highlights for di Big Brother Naija season 5 Day one
Di excitement don begin for Big Brother Naija season 5 as Day 1 don come and go.
Dis na some of di main- di main tins wey happun on di first day of di 2020 season.
- Big Brother Naija season five go happun for July
- Meet di housemates of Big Brother Naija lockdown Season 5
Head of House
Afta enough completion for who go become head of house, di first head of house don show for di 2020 BBNaija competition.
Di first head of House and deputy head of House for di 2020 show na two women Rebecca Nengi Hampson and Florence Wathoni Ayansi.
Di Head of House, Nengi dey 22 years. Her age no go down well wit some pipo wey feel say she too young to lead di Big Brother House.
Love don begin catch fire
Some housemates don begin pick dia love and pipo wey dem go do alliance or collabo wit for di house.
E be like BBNaija don dey get im own entangelement! Erica dey try connect wit Ozo but e be like say Ozo get eye for, and dey try im luck wit Nengi.
Can this ship happen neh? They look good together. Ozo ati Nengi #BBNaijaLockdown #BBNaija pic.twitter.com/xB9gDe0XV1
— Mommy Chizzy❣️ (@Mummy_Chizzy) July 20, 2020
Eric liked Erica but now it’s Lilo.
Erica likes Eric, but she ain’t getting the attention so she’s diverted to Ozo.
Ozo likes Nengi.
Nengi is still searching.I like the entanglement already#BBNaija pic.twitter.com/nVkCXPP8nu
— Deuces🎲🕑 (@Deuces1Deuces) July 20, 2020
Ozo be looking lik entanglement in human form..😑… Lets be watching sha😊 #BBNaija pic.twitter.com/W9JTLs2yXE
— Baby_Soja😘 (@sangebabysoja) July 19, 2020
Lilo and Eric dey gum demsef dey go already. Dis na love dey for air so?
Guys, i think lilo found love on the first night. I sincerely hope it doesn’t end in tears for my girl 😭.#BBNaija pic.twitter.com/KNvQwpGeYq
— Dr. Fisher (@Lordfisher2) July 20, 2020