Nengi BBNaija age: Rebecca ‘Nengi’ Hampson na di first Head of House Big Brother Naija 2020 housemates

Rebecca ‘Nengi’ Hampson don become di first Head of House for di ongoing 2020 Big Brother Naija reality TV show.

Nengi win di special position afta defeating oda contestants wey bin do di challenge.

She come pick Florence ‘Wathoni’ Anyansi, her fellow housemate, as her deputy.

Both Nengi and Wathoni go enjoy di HoH room and every benefit wey come wit am.

Nengi, na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures.

She study communications for di University of Port Harcourt. She say she like clean place, clean pipo and like to dey true to hersef.

She be proud Capricorn.

Wathoni, on the other hand, is a 29-year-old fashion entrepreneur.

Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time

She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo.

HOH Benefits

Organisers of Big Brother Naija 2020 bin don earlier announce inside one statement say dis year edition go witness upgrade in terms of benefits wey di Head of House (HOH) go fit enjoy compared to winners from previous ones.

“Dis year, di HoH privileges go see some major upgrades. For dis new season, di Head of House go get to enjoy a lounge all to themselves! Di HoH lounge go get living room area, bedroom, fitted bathroom, and a private bathroom,” Di organizers tok for statement.

“Additionally, di HOH go dey allowed to select a deputy to assist dem to cari out dia duties and dem fit get to add some BBNaira to dia Betway Wallet….”