NDDC: Who be Professor Kemebradikumo Pondei?

As one Nigerian committee dey torchlight how Niger Delta Development Commission take spend billions of Naira, e good make we ask who Prof Kemebradikumo Daniel Pondei

be.

Pipo begin react afta Pondei on July 20, 2020 become di main tori afta im “faint” ontop live television.

Prof Pondei na di acting managing director of di NDDC, na as im dey ansa kweshion for di hand of di House of Representatives committee wey dey probe NDDC, e just collapse ontop chair.

Dem later comot am from di hearing room.

Sharp-sharp facts about Daniel Pondei

  • Dem born Kemebradikumo Daniel Pondei for Bayelsa State.
  • Im attend Federal Government College, for Port Harcourt, Rivers state.
  • Oga Pondei get Bachelor of Medicine, Bachelor of Surgery & MBBS, from di University of Lagos
  • Oga Pondei get PhD for Microbiology from University of Nottingham
  • Im be one time Provost of di College of Health Sciences, Niger Delta University
  • Im also be di Former chairman of di Nigerian Medical Association, NMA, Bayelsa State
  • Dem apoint am as acting MD of NDDC on 19 February, 2020.