NDDC Acting MD Kemebradikumo Pondei collapse, probe committee oga Bunmi Tunji-Ojo step down for live television wen Godswill Akpabio show to reply Joy Nunieh allegation

NDDC Acting MD, Prof. Kemebradikumo Pondei collapse for probe hearing today. Tori be say as e dey give account of how much e spend under im watch na im e collapse. Now dem don take am away from for di hearing room.

Drama, fear and chaos for di House Committee hearing on NDDC as Prof. Pondei collapse for chair as e dey ansa kwesion from lawmakers.Many of those wey come wit am begin to press im mouth open and pour am water for face to make sure say dem wake am up from di seizure.Afta dat dem come evacuate am from di hearing room.

Meanwhile Bunmi Tunji-Ojo, di NDDC probe committee chairman don step downfrom di Niger delta Development Commission investigative committee of Nigeria House of Representatives.

Oga Tunji-Ojo step down from im position for di House Committee Public Hearing on NDDC wey dey happun now for di kontri capital Abuja.

https://www.facebook.com/watch/?v=516290095792394

On Thursday 16 July, 2020, management of NDDC led by di Acting MD, Prof. Kemebradikumo Pondei stage walkout of of di panel after dem accuse dem of corruption.

Prof. Pondei say, “We for NDDC no dey comfortable with di Chairman of dis committee wey dey preside over dis matter. Im na interested party and we no believe say di NDDC go get justice because im no go fit sidon judge im own case.

We no get any issue to appear as we don appear before di Senate ad hoc committee but as long as im remain dia, we no go make any presentation.” Na so Prof. Pondei tok.

Dis come make di House of Reps Committee on NDDC issue warrant of arrest on di Acting MD of NDDC.

Joy Nunieh biography and GodswillAkpabio

BBC

NDDC Forensic Audit & Nunieh sack

Dr. Joi Nunieh become di Acting MD to head di Interim Management Committee IMC of NDDC for October 2019.

President Muhammadu Buhari set up di IMC to conduct forensic audit of di over N2trillion alleged debts wey NDDC dey owe since dem start work as a Commission and na di Minister of Niger Delta Affairs, Sen. Godswill Akpabio inaugurate dem.

For January 2020, Dr. Nunieh begin contract verification exercise to register and verify evri contractor with NDDC, to prepare for di actual forensic audit.

But Nunieh chop sack for February 2020 and a new MD, Prof. Kemebradikumo Pondei replace her as Acting MD.

Tori be say di choice of who go lead di forensic audit of di NDDC contribute to di reason for her sack because Federal Executive Council bin don approve Messrs Olumuyiwa Bashiru and Co. as lead consultants for di audit but she bin want make di Financial Intelligent Unit and World Bank supervise di forensic audit to avoid manipulation of di process.

Minister for Niger Delta Affairs, Sen. Akpabio come call for a tripartite meeting between di ministry, NDDC and di lead consultant, but Nunieh no gree attend dat meeting wey make di Minister report her to di President come sack her for gross insubordination.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.