Big Brother Naija Season 5 housemates names: Dorathy Bachor Instagram page ‘blow’ just afta BBNaija show launch

Dorathy Bachor Instagram page look like di true reality of “hoping to get di best time of her life” as her followers increase overnight afta becoming Big Brother Naija housemate.

Di BBNaija female housemate from Delta State, southern Nigeria wey dey contest di 2020 television reality show bin tell di show host on Sunday for di live lunch say she hope to get di best time of her life during di show.

And true-true day neva break but dat hope don begin look real on her Instagram page of 6687 Followers, 230 Following, 20 Posts.

Between 7pm hour on Sunday 19 July, wen Dorathy Bachor show for Big Brother house and 5am di next day, her IG account: @thedorathybachor don hit nearly 40 thousand followers wit 21 posts, 39.4k followers, 235 following at di last check.

Many fans of di BBNaija show on Sunday night identify her as Dorothy but she don clear di mata say make dem make her trend as Dorathy.

Who be Dorothay Bachor?

Dorathy Bachor na 24-year-old entrepreneur from Delta State and she believe she be di only one wey fit make you smile.

She say her biggest achievement na SHOPFORME – dat na di biggest procurement company inside Nigeria.

How Big Brother Naija season 5 go be?

20 new housemates wey enta di Big Brother Naija house on Sunday 19 July no go observe social distancing. Dat na because dem don clear dem of any medical condition including Covid-19.

During di 10 weeks wey dem go stay for di house Big Brother go assign housemates task wey involve team play wey Big Brother know and di housemates need to find out.

Some of di general rules for di house na say di housemates no go get any contact with di outside world, no violence and dem must nominate dia fellow housemate for eviction.

Shower hour no go dey dis season according to di organisers. No be only dat one wey dem cancel for dis season.

No guest go dey allowed inside di BBNaija house or come in contact wit housemates.

Dem also reduce di number of ninja dem too and canel all audience for di live eviction show.

Ebuka go host di Sunday live eviction show for empty studio and den cross live inside di Bigbrother house.