Joy Nunieh NDDC probe, Godswill Akpabio and Police house arrest plus Ezenwo Nyesom Wike rescue as Govnor of Rivers State – See how far her mata don waka

Joy Nunieh latest news ontop dis NDDC probe na say police don ask Govnor Nyesom Wike to produce di sacked former MD of Niger Delta Development Commission.

Rivers State Commissioner of Police, Joseph Mukan tell di Rivers State Govnor to hand over Dr. Nunieh wey im rescue from security officers wey bin go arrest her from her house, come cari her go goment house, Port Harcourt on Thursday 16 July, 2020.

CP Joseph Mukan tell tori pipo on Friday for Police Headquarters Port Harcourt say as di chief law enforcement officer for di state, if di Govnor rescue pesin, im suppose give di pesin to police wey dey in a better position to protect her.

Di Police Commissioner emphasise say di exercise on Thursday 16 July, 2020 wey security agents go Nunieh house, na di Inspector General of Police IGP Monitoring Team from Abuja wey dey on legitimate duty do am as dem get clearance from am before dem go her house so wetin dem do dey within di confines of di law so make di Governor turn her over to di Police.

CP Mukan explain say no be evri situation wey police need warrant of arrest as some situations no need am, so di fact say di officers no get any warrant of arrest no make di exercise illegal one.

Di Rivers State Police boss explain say di Police Officers go Nunieh house to invite her because e get petition dem dey investigate about her, wey no get anytin to do with di issue for di National Assembly.

For di one wey Govnor Wike say di Commissioner of Police no dey aware of di operation, di CP Mukan say dem dey aware of di exercise and nobody try to reach am about am, come add say “ordinarily if dem say I no dey aware, dem try to find out from me weda I dey aware or not? I endorse di officers investigation activities and I dey aware of dia presence here.”

Nunieh testify before House of Reps through video link

Meanwhile di former Acting MD of NDDC Dr.Joi Nunieh don testify before di House of Committee on NDDC via video link.

Nunieh suppose appear before di House Committee on Thursday 17 July, but dat one no happen as security agents for early morning by 4am, surround her house for Port Harcourt wey prevent her from travelling to Abuja.

Di House Committee on NDDC also don summon di Minister of Niger Delta Affairs, Sen. Godswill Akpabio and di Acting MD of NDDC, Prof. Kemebradikumo Pondei to appear before dem on Monday 20 July to make dia presentations and answer queries against dem.

“I no go fit dey and see any Rivers daughter suffer” – Wike

E take di intervention of Rivers State Governor, Nyesom Wike to rescue her come carry her go Goment House.

Small drama happen wen di Governor reach her house come ask di security agents if dem get warrant of arrest, and also say im ask di State Police Commissioner weda im dey aware of di operation but di Commissioner say im no know, wey make di Governor carry her comot go Goment House as im say im no go dey see any Rivers daughter or Rivers pesin suffer. So Nunieh dey take refuge for Rivers State Goment House.

‘Officers for Nunieh house dey official duty’- Police

But di Rivers State Police Command for Friday 17 July morning release Statement say di security agents wey bin dey Nunieh Port Harcourt house bin dey on legitimate, official duty as dem be Inspector General of Police IGP Monitoring Team from Abuja.

For Press Statement wey di Police tok tok pesin Nnamdi Omoni sign, e clarify say before di IGP Monitoring Team from Abuja go Nunieh house, dem observe due protocols and necessary standard operating procedures wey include reporting to di Headquarters, with dia investigation activities duly signed and approved by di Commissioner of Police, Joseph Mukan, naim make dem go with Mobile Policemen to show say na official duty dem dey.

Di statement come add say any reference say di officers bin dey dia without di directive of di Commissioner of Police or Inspector General of Police no be true so make pipo no regard am.

Nunieh accuse Akpabio of sexual harassment

All dis na sake of accuse Dr. Joi Nunieh sama di Minister of Niger Delta Affairs, Sen. Godswill Akpabio about financial misappropriation for di probe wey House of Reps members dey chook eye for wetin happen for di NDDC between October 2019 to May 2020.

Dr. Nunieh for interview accuse Sen. Akpabio of sexual harassment among oda tins and Akpabio react.

‘Joi Nunieh accuse against me na lie’ – Akpabio

Di Minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio, say all di allegation wey di former Acting MD of NDDC, Dr. Joi Nuni sama against am dey false.

For Statement wey im Media Aide Anietie Ekong sign, Sen. Akpabio say all di allegation of corruption, sexual and workplace harassments, pipelines bombings, secret cult activities, abuse of office, among odas na lies and im take time address all of dem one by one.

Di Minister of Niger Delta Affairs say im bin want im lawyers and di judicial system to vindicate am of all di false allegations against am, but im gatz react, especially to di one on sexual harassment.

Senator Akpabio say as man wey marry and get four daughters, im respect women well well and all through im time as Governor of Akwa Ibom State, im empower and promote women well well and even be di first Governor wey get female deputy Governor for South South region. Im say e no get any time, place or circumstance wia im make any form of sexual advances to Ms. Nunieh, not even to put imsef for a position wey fit suggest sexual advances towards Ms. Nunieh, or any female staff of im Ministry or for NDDC.

Sen. Akpabio wonder why Ms. Nunieh no ever see reason to report di alleged incident to police at di earliest opportunity she get, before, during or after her tenor as di Acting Managing Director on 17th February, 2020, if indeed di allegation na true, but she wait till July 10 and 13 2020 when di National Assembly begin probe some of her actions as Acting Managing Director of di Interim Management Committee to expose her motive, especially for time when di Forensic Audit Investigation for NDDC dey hot and di truth go show for evribodi to see.

On top di allegation of contract racketeering, bombing of oil pipelines, corruption/ diversion of funds, di Minister say im don only award three contracts till date- wey be:

  • appointment of di lead forensic auditors wey di Federal Executive Council approve,
  • di emergency procurement contract for COVID-19 intervention for Niger Delta Area wey because e dey urgent get im interim approval and
  • di Presidential approval in line with Bureau of Public Procurement Act and award of vehicles procurement wey dey duly approved by di Bureau of Public Procurement and the Federal Executive Council but dem never do am.

Ontop her allegation say di Minister direct her to change Dollars for NDDC Account; for di records, im note say NDDC Account dey with Central Bank of Nigeria. So Every inflow and outflow dey known and traceable. Im explain say NDDC dey get revenue in Dollars wey dem dey pay directly to di Treasury Single Account (TSA) with Central Bank of Nigeria. Den CBN go convert Dollar to Naira and pay into di NDDC Naira account wey still dey with CBN upon a written application from NDDC. So e dey impossible for any sum of money wey belong to NDDC with CBN including di figures dem say dey missing to dey missing.

Sen. Akpabio say tins no dey like before wen NDDC get over three hundred (300) bank accounts for different commercial banks, as dat practice don change since President Buhari administration give full effect to di application of di Treasury Single Account and so NDDC now get accounts with CBN. So di Minister no dey give verbal instructions to anybody, all instructions dey in writing and in response to a request from di Commission.

On the allegation say di Minister direct Ms. Nunieh to remove Mr. Kaltungo, say e dey false. As e dey known say di Minister no dey look tribe and im get friends from Northern Nigeria. Di Minister get information say di NDDC management get over twenty three (23) top Management Staff, from various part of Nigeria including Niger Delta region, wey don dodge leave for di last ten (10) years or get tendency to negatively influence di ongoing forensic audit so dem bin dey recommended for mandatory leave by di lead forensic auditors. Im say dem still be staff of di Commission wey still dey receive dia monthly salaries and benefits.

Di Minister don instruct im lawyers to seek redress for Court for am over di defamatory statements wey Ms. Nunieh make. Im also encourage all Nigerians to hold dia leaders to account, and sieve wetin dem dey hear before dem conclude.

Why National Assembly dey probe NDDC?

Nigerian Senate and House of Representatives dey investigate allegation of mismanagement of over N40 billion naira by di Interim Management Committee IMC of di NDDC.

Chairman of di House Committee on NDDC Olubunmi Ojo na im dey head dis probe panel for House of Reps. But di IMC dey accuse Olubunmi Ojo of corruption say im receive N3 trillion naira contract from NDDC but im deny am say na blackmail to stop dia work to probe NDDC.

Why NDDC walk out on House Committee

On Thursday 16 July, 2020, management of NDDC led by di Acting MD, Prof. Kemebradikumo Pondei stage walkout of of di panel after dem accuse dem of corruption.

Prof. Pondei say, “We for NDDC no dey comfortable with di Chairman of dis committee wey dey preside over dis matter. Im na interested party and we no believe say di NDDC go get justice because im no go fit sidon judge im own case.

We no get any issue to appear as we don appear before di Senate ad hoc committee but as long as im remain dia, we no go make any presentation.” Na so Prof. Pondei tok.

Dis come make di House of Reps Committee on NDDC issue warrant of arrest on di Acting MD of NDDC.

Joy Nunieh biography and GodswillAkpabio

BBC

NDDC Forensic Audit & Nunieh sack

Dr. Joi Nunieh become di Acting MD to head di Interim Management Committee IMC of NDDC for October 2019.

President Muhammadu Buhari set up di IMC to conduct forensic audit of di over N2trillion alleged debts wey NDDC dey owe since dem start work as a Commission and na di Minister of Niger Delta Affairs, Sen. Godswill Akpabio inaugurate dem.

For January 2020, Dr. Nunieh begin contract verification exercise to register and verify evri contractor with NDDC, to prepare for di actual forensic audit.

But Nunieh chop sack for February 2020 and a new MD, Prof. Kemebradikumo Pondei replace her as Acting MD.

Tori be say di choice of who go lead di forensic audit of di NDDC contribute to di reason for her sack because Federal Executive Council bin don approve Messrs Olumuyiwa Bashiru and Co. as lead consultants for di audit but she bin want make di Financial Intelligent Unit and World Bank supervise di forensic audit to avoid manipulation of di process.

Minister for Niger Delta Affairs, Sen. Akpabio come call for a tripartite meeting between di ministry, NDDC and di lead consultant, but Nunieh no gree attend dat meeting wey make di Minister report her to di President come sack her for gross insubordination.