Coronavirus update in Nigeria: How to spot fake hand sanitizers for market

Hand sanitizer

BBC
Coronavirus don make many pipo to dey use hand sanitizer

Hand sanitizers don become one of di essential commodities alias tins wey you suppose hold for bodi dey waka about sake of coronavirus.

But how to spot di fake ones for Nigerian market dey very important now because di Nigeria Institute for Pharmacetutical Research and Development, NIPRD say 63% of hand sanitizers for Abuja, di kontri capital na fake.

Dia tok dey come as di kontri still dey battle di coronavirus wey don infect at least 34, 854 pipo and kill 769 pipo ast at Friday 17 July, 2020.

Di World Health Organisation (WHO) recommend hand sanitizer as di next tin to use kill germs for hand, if water and soap no dey available.

But to use hand sanitizers alone no go stop di spread of dis disease according to authorities. Dem advise pipo to follow di health guideline wey include to wear face mask for public, wash dia hands wit soap and water and to maintain social distancing.

How to spot fake hand sanitizers for market

According to informate wey federal ministry of health give dem say if pesin enta market to buy sanitizer dem need to shine dia eye well-well to see if di product get these tins.

  • Check if di hand sanitizer get manufacture and expiring date if e no get e mean say na fake.
  • Check if di hand sanitizer contain 60% alcohol inside, if e no get na fake.
  • Check if di hand sanitizer get NAFDAC number, if e no get na fake.
  • Check di label for di body of hand sanitizer wey you dey buy if e no dey kampe na fake.