Yahya Jammeh: US accuse ex-Gambia leader say e use public money take buy $3.5m mansion for America

Yahya Jammeh

Getty Images

Di US justice department dey accuse former Gambian President Yahya Jammeh say e use money wey im collect from bribery and from magomago for goment to buy mansion for Washington during di time e dey power.

Documents wey dem present so as to seize di property for di US capital, Washington show say Oga Jammeh buy di $3.5m house about 10 years ago.

Tori be say im buy di property through one joinbodi wey im wife Zineb Jammeh bin arrange.

Di former presido rule di west african nation for more than 20 years.

E run comot di kontri afta e lose di 2017 elections and now e dey live for Equatorial Guinea.

President Teodoro Obiang Nguema of Equatorial Guinea bin don vow say im go ‘protect’ Jammeh for im kontri.

For August 2019, Gambia release new currency notes wey get di national birds ontop, to take am replace foto of former Jammeh.

Sharp-sharp profile of Yahya Jammeh

  • Born for May 1965
  • Seize power inside coup for 1994 as 29-year-old army lieutenant
  • In 2011, he vow to stay for power for “one billion years” if God will am
  • E order make dem execute criminals and political opponents for death row
  • Claim for 2007 say im fit curee Aids and infertility with herbal mixture
  • For 2008 warn say im go behead gay pipo
  • Deny say im security agents kill journalist Deyda Hydara for 2004

‘Rule for a billion years’

For one 2011 interview with di BBC, when im still be president, oga Jammeh tok say im no fear say wetin happen to Libya leader Muammar Gaddafi wey dem kill or Egypt President Hosni Mubarak wey dem comot, fit happun to am.

“My fate dey di hand of almighty Allah,” im tell di BBC.

“I go deliver di Gambian pipo and I need to rule di kontri for one billion years, I go do am, If Allah tok so.”

5 years afta di pipo of Gambia vote Jammeh comot for power, and im decision to step down from power surprise even im rivals. Although, small time afta, Jammeh do u-turn decide say im go stay for power.

ECOWAS call meeting ontop im head and decide say make e comot by force. On 21 January 2017 e enta plane comot im own kontri on exile.