Ossouka Raponda Biography: What you need to know about Gabon first female prime minister

Rose Christiane Ossouka Raponda don become di first female Prime Minister for Gabon.

Gabon President Ali Bongo bin appoint her to replace Julien Nkoghe Bekale wey hold di position for eighteen months.

Who be Rose Christiane Ossouka Raponda?

Rose Christiane Ossouka Raponda na 56 years old and she member of di ruling party.

Raponda get degree for economics from di Gabonese Institute of Economy and Finance.

For 2014, she become di first female mayor for di kontri capital, Libreville. Wen she dey that position, she bin perform very well and leave surplus money for di institution budget.

Dem appoint her as defence minister for February 2019 afta one failed coup against di president.

Wetin she go do for dis new role

Her main mission for dis new role na to turn around di economy of di kontri and to continue to dey provide social support to di Gbonese pipo wey dey feel di impact of coronavirus.