Kamaru Usman vs Jorge Masvidal UFC 251 results: ‘Nigerian nightmare’ win to retain im Welterweight title – See how di fight go

Usman VS Masvidal fight

Getty Images

Nigerian American mixed martial artist, Kamaru Usman don defeat Jorge Masvidal to retain im UFC 251 Welterweight Championship.

Na for di fifth round, di Nigerian nightmare win im arch-nemesis Jorge Masvidal. Masvidal wey bin fight for im first official UFC title on six days notice for Abu Dhabi.

Kamaru Usman defeat Jorge Masvidal via unanimous decision (50-45, 50-45, 49-46)

Dis na di 11th time wey di 33 year old Nigerian-American Usman go win UFC championship and di 3rd time im go defend im title for Abu Dhabi.

Usman VS Masvidal fight

Getty Images

See as di fight waka

Round one

Jorge Masvidal look explosive for di standup and e give Kamaru plenty of problems with di different angles of entry to engagement.

Gamebred takedown defence bin dey surprisingly strong against Usman too and di more dem trade fight for di first round, di more Usman bin wan grab Masdival and wear am down.

Round two

Di way Usman clinch work dominate most of dis round. Commentators begin reason whether na dis round im go beat Masdival .

For di final moments of di round, Masvidal come back wit force wey shock di champion, but Usman still take charge of di second round.

Round three

Usman catch Masvidal with low blow wey stop the momentum of di round, but before dis time, di Nigerian Nightmare don dey carry out im plan of how im go work against di cage.

Afta di break , Usman score one fantastic takedown as Masvidal wage war at di champion and Usman give am some elbows to chop.

Na Usman get di lead for dis round

Round four

Once again, Usman try im best to clinch im opponent. na ontop di clinch dem spend most of di round. but wen Masvidal break free, he don tire pass as im be for di previous rounds and im no fit deliver di damage im bin dey plan for Usman.

But Masvidal still remain dangerous.

Round five

Masvidal try, im work tirelessly to get out of Usman hold, but ultimately, Usman dictate di final round wit im grappling skills- di way im dey grab..

Wen Gamebred finally break free, he bin get some force for di end but, unfortunately, e no reach am to get di win despite di way im look dangerous

Dem declare Usman di winner of dat round and di ultimate winner of di fight.