Lagos Island building collapse: Three story building collapse today for Lagos Island – Fotos and how e happun

Lagos state Emergency Management agency (LASEMA) say dem don recover three bodies from di three story building wey collapse today for Freeman Street, Lagos Island.

DG of LASEMA, Femi Osanyintolu tell BBC say from preliminary report, di building wey dey Lagos Island, collapse due to structural defect and building controlling ogas dem bin don mark dat building before.

According to oga Osanyintolu, one young boy dey among di two bodies wey dem comot from di collapse building.

LASEMA tok-tok pesin, Nosa Okunbor add say total of 9 pipo na im dem don rescue alive, and recover 3 recover dead bodies.

Report from eye witness wey dey ground say di building collapse around 3 : 00 a.m and like 9 to 10 pipo na im dem say live inside di building.

Di eye witness say di family wey dis collapse building affect bin just newly move enta as di before pipo wey dey stay inside move out with di excuses say dem wan renovate am. But di developer bring in new pipo enta di building as di renovation work dey on.

LASEMA plus LASAMBUS join hand together do pre-hospital care to one of di boys wey dem rescue from di collapse 3-storey building.