Mohammed Umar na di new EFCC acting Chairman afta Buhari suspend Ibrahim Magu

Nigeria President Muhammadu Buhari don confam di suspension of Ibrahim Magu as di acting Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC)

Dis na as im dey ansa case ontop accuse of misconduct.

Magu suspension by di president wey be with immediate effect come inside announcement on Friday from di office of di Attorney-General of di federation and Minister of Justice.

Di statement also direct di EFCC Director of Operations, Mohammed Umar, to take charge and oversee di activities of di commission.

Wetin be di accuse against Magu?

One presidential panel dey investigate di activities of di agency under di administration of Magu wey reports don dey detention since on Monday.

According to tori, dis one dey come afta accuse of misconduct against am from di Attorney-General of di federation, Abubakar Malami.

Malami bin write to Buhari, to ask make dem comot Magu as di acting chair of di anti-graft agency.

Di Panel wey former President of di court of appeal Ayo Salami dey lead bin invite Magu to hear im own side regarding wetin dem dey accuse am and how e dey run EFCC.

Di work ahead of Umar

Umar Abba na di deputy commissioner of police and director of operations for di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC)

EFCC major task na to ensure say dem wipe di kontri clean from all economic and financial crimes, na huge task wey di commission since dem establish am for 2003 don dey try to do.

Human right lawyer, Bamigboshe say one major challenge for di new man in charge go be to win back di confidence of Nigerian pipo.

E say di agency gatz work hard on top dia public image as many Nigerians now believe say di agency no dey accountable.

Security consultant and former oga of DSS, Mike Ejiofor say oga Muhammed must try to reposition di agency and enable am do beta job wey Nigerians go dey proud of am.

E explain say one major challenge wey oga Muhammed gatz solve na to make sure say di agency dey professional plus dem gatz stop di media trial of people. E say if dem dey more professional and no target one political group, Nigerians go happy for am.

Anod atin na diligent investigation. Oga Ejiofor say since dem establish di EFCC, di agency get fault on top how to investigate high political corruption mata.

E say many of di conviction wey dem dey secure, na for yahoo-yahoo boys dem and dat di major task for di new chair na to improve for investigation, plus EFCC go need to collabo wit oda agency of goment to achieve beta result.