Hushpuppi extradition: FBI tok how Ramoni Igbalode try tiff $124m from premier league club plus oda new informate

Di America Federal Bureau of Investigation (FBI) don tok say Ramon Olorunwa Abbas aka Hushpuppi, almost thief $124m from premier league.

FBI tok dis for inside di press statement wey dem release for dia official website on Friday.

For di statement, FBI tok say dem dey charge am for money laundering wey worth millions of dollars wey im allegedly thief for business email compromise (BEC) frauds and oda scams.

Oda tins wey FBI tok

Part of di scam wey Abbas and odas try to do na to steal £100 million (approximately $124 million) from one English Premier League soccer club. Di agency no mention di club.

According to affidavit wey FBI dey quote Abbas “be one of di leaders of transnational network wey facilitate computer intrusions, fraudulent schemes (including BEC schemes), and money laundering, wey target victims around di world for schemes dem design to steal hundreds of millions of dollars.”

FBI also say di affidavit allege say Abbas and odas commit one BEC scheme wey defraud one client of law firm wey dey New York of approximately $922,857 for October 2019.

“Abbas and co-conspirators allegedly use cunny cunny trick one of di law firm’s paralegals make dem wire moni wey suppose be for di client’s real estate refinancing to one bank account wey Abbas and im co-conspirators dey control.

“Di affidavit also allege say Abbas conspire to launder $14.7 million wey in tiff for cyber-heist from one foreign financial institution for February 2019, im con send di stolen moni to bank accounts around di world. Abbas also provide one jaguda pesin wey get two bank accounts for Europe wey im expect say dem go each get €5 million (about $5.6 million) of di fraudulentl moni.”

If dem convict Abbas and im oda conspirator, dem fit get 20 years for America federal prison.

Police for Dubai first arrest Ramoni Igbalode AKA Hushpuppi, Olalekan Jacob Ponle aka Woodberry and some odas and con give dem to America FBI were dey go face di gbege wey dem do.

Dubai Police bin announce on July 2, 2020 say dem dey hand over alleged Nigerian fraudster Raymond Igbalode Abbas alias Hushpuppi to di Federal Bureau of Investigation (FBI) for America.