
Di Premier League, English Football League and Professional Footballers’ Association don announce one new scheme to increase di number of black, Asian and minority ethnic coaches (BAME).
Di plan na to assist BAME players move into full-time coaching roles for di professional game.
Di scheme go start next season and six coaches go get opportunity of 23-month work for EFL clubs every season.
PFA members fit apply anytime, no mata dia age or which stage dem don reach for dia career.
- 10 times wey Messi show di world say im be legend
- Liverpool don end dia 30-year wait for di Premier League title
“Dis na critical time for black, Asian and minority ethnic coaches,” tok Doncaster Rovers manager Darren Moore, wey be chairman of Premier League’s black participants’ advisory group.
“We all know and agree say diversity of coaches and managers must increase and dis work scheme na positive step.
“Plenty role dey di academy system, till pesin reach di first team, and young coaches fit find work for di different different areas to begin di journey.”
Right now, na only six of di 91 Premier League and EFL managers or head coaches na im be pipo from BAME.
Wetin be di conditions?
- Candidates must get minimum of Uefa B qualification and commit to dia Uefa A coaching licence.
- Dey must also do FA Advanced Youth Award programme
- Candidates go do individual club interviews
“We need more BAME coaches to enter di system,” na wetin Premier League oga Richard Masters tok.