APC NEC meeting: Gov. Buni na im be new APC national chairman as NEC meeting clear Ize Iyamu Edo primary election – Meet di new leadership of Nigeria ruling party

APC national chairman and some Govnors afta di APC NEC meeting on Thursday

BBC

Governor of Yobe State, Mai Mala Buni don become di national chairman caretaker committee of Nigeria ruling All Progressives Congress (APC).

Dis dey come shortly afta dem dissolve di party National Working Committee (NWC) alias party executives during di meeting of di party National Working Committee wey happun on Thursday, 25 June.

Di decision follow recommendation of President Muhammadu Buhari wey also attend di meeting. For di meeting, dem also clear Pastor Ize Iyamu as di party candidate for di Edo state governorship election.

Dis dissolution di party executives mean say di APC NWC no dey exist again until further notice. For di meantime a new caretaker committee na im go lead di party, di APC NEC meeting decide.

Meet di APC Caretaker Committee and Extra-Ordinary Convention Planning Committee

1. Govnor Mai Mala Bun of Yobe State – Chairman

2. Isiaka Oyetola – South West

3. Ken Nnamani – South East

4. Stella Okorete – Women Rep

5. Govnor Sani Bello – North Central

6. Dr. James Lalu – physically challenged

7. Sen. Abubakar Yusuf – Senatè Rep

8. Hon. Akinyemi Olaide – Reps

9. David Lyon – South South

10. Abba Ari -North West

11. Prof. Tahir Mamman – North East

12. Ismail Ahmed – Youth

13. Sen. Akpan Udoedehe- Secretary

Man dey hold APC flag

Getty Images
President Muhammadu Buhari win din 2015 and 2019 elections under All Progressives Congress

Di Acting National Chairman of di party Victor Giadom na im call for dis meeting and President Muhammadu Buhari also attend di meeting inside Abuja.

Shortly afta di meeting, Giadom reaction be say “my take on di outcome of today APC NEC meeting be say: I bin don earlier say di collective decision of di entire NEC go prevail inside today meeting. I also promise to stand by any decision wey dem decide.

Di new party chairmo wey be oga Buni go organize national convention to elect new national officers of di goment party.