Ajimobi dies: Senator Abiola Ajimobi don die – See wetin we sabi about di death of di ex-Govnor of Oyo State

Senator Abiola Ajimobi, wey bin former govnor of Oyo State, south west Nigeria don die at di age of 70.

Na one close aide of di Senator confam di tori of Ajimobi death to BBC Pidgin on Thursday evening of 25 June.

Oda of im close friends don begin post sorry messages of im death. Tori be say im die for one private hospital inside Lagos.

Oga Ajimobi dead mata land afta di former govnor spend weeks inside intensive care for coronavirus complications, according to wetin Akin Alabi wey be federal lawmaker and political associate of di late senator tok.

Di family say dem go bury Ajimobi on Friday for Ibadan, di Oyo State Capital, BBC Pidgin find out.

Who be Abiola Ajimobi?

Dem born am as Isiaka Abiola Ajimobi on 16 December, 1949.

Na for im state of origin Oyo, im do im primary and secondary education.

Ajimobi travel go America for im university education wia im study Business Administration and Finance for State University of New York and later do MBA for State University, Illinois.

E marry Florence 1980 and dem get five children.

Im political career begin for 2003 when im bin serve as Deputy Minority leader for Senate. By 2007 im contest to be govnor of Oyo State but e no win am.

For 2011, e become govnor for di first time, and later e break record for Oyo to be di first pesin to do two democratic terms back-to-back for di state.

Around 18 June, rumours bin dey fly upandan say di lawmaker and former govnor don die, only for im daughter Fatima Ganduje-Ajimobi to comot for social media to deny am.

Inside interview with BBC Yoruba on Tuesday, 16, June , 2020, im tok-tok pesin Bolaji Tunji tok say ‘Ajimobi say im go settle all di wahala wey dey di political party during dia National Executive Council (NEC) meeting’.

Oga Tunji also bin deny all di rumours wey dey fly around say senator Ajimobi dey coma and dey receive treatment for hospital.