Buhari advise APC National Executive Committee meeting wey Giadom call to dissolve di party National Working Committee

Man dey hold APC flag

Getty Images
President Muhammadu Buhari win din 2015 and 2019 elections under All Progressives Congress

Nigeria ruling All Progressives Congress APC don dissolve di party National Working Committee alias party executives.

Dis tori mean say di National Working Committee (NWC) of Nigeria ruling All Progressives Congress – APC no dey exist again, na di decision wey dem just take for di party National Executive Committee – NEC meeting on Thursday.

Di Acting National Chairman of di party Victor Giadom na im call for dis meeting and President Muhammadu Buhari dey also attend di meeting inside Abuja.

Di decision follow recommendation of President Muhammadu Buhari and dis one mean say di National Working Committee (NWC) of di All Progressives Congress (APC) don dey dissolved.

Dem also appoint caretaker chairman wey go organize national convention to elect new national officers of di goment party.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.