Victor Giadom: President Buhari snub Tinubu group to support Chief Victor Giadom as di ‘authentic’ Acting National Chairman of All Progressives Congress as Ajimobi NWC kick ahead of APC NEC meeting

Muhammadu Buhari - Di President of Nigeria recognise Victor Giadom as APC acting National chairman on Wednesday

Victor Giadom/Muhammadu Buhari

President Muhammadu Buhari on Wednesday throw im weight behind Victor Tombari Giadom as di ‘authentic’ acting national chairman of Nigeria ruling All Progressive Congress (APC) party.

Dis one mean say di drama and confusion wey cover di goment party be like say e don dey end now wey Buhari don support Giadom as di only party national chairmo out of di oda factions wey dey claim di position.

“President Buhari don receive advice wey convince am on di position of di law as far as di situation dey for di party and im don determine say di law dey on di side of Victor Giadom as Acting National Chairman.”

Na wetin Buhari tok-tok pesin, Garba Shehu announce for tweet and message e send give tori pipo for di presidential palace (Aso Rock) inside Abuja.

Oga Giadom tell BBC Pidgin say as di presidency don recognise am as di acting national chairman of di party, im dey ask all di members of di All Progressive Congress to support di NEC meeting wey go happun on Thursday 25 June, make dem for fit find lasting solution to all di crisis for di party.

Im add say now wey e don dey obvious say na im be di party national chairman , im go ask every oda pesin wey di decision affect to join hand wit am make dem for fit solve all di gbas-gbos wey dey happun for di party.

President Buhari go attend di NEC meeting wey Giadom go chair, di presidential statement add for di tori.

Di Senior Special Assistant to di President on Media and Publicity, Garba Shehu, wey announce dis one also say di president don ready to attend di virtual meeting of di National Executive Council wey Giadom announce say go hold on Thursday.

Di ruling APC don dey face leadership crisis for weeks now.

Buhari tok-tok pesin further yarn give say becos di Nigerian presido na man wey di respect law always, e go act according to di law by attending di meeting wey go happun on Thursday afternoon.

Plenti political interest for di party don dey cause kasala on top who go control the soul of di party afta Abuja Court ask give Adams Oshiomhole suspension make im step aside.

While di Adams Oshiomhole NWC -National Working Committee dey back Senator Abiola Ajimobi wey many party members believe say get di anointing of Bola Tinubu wey be political heavy weight from di south-west political zone, oda groups inside APC dey back Victor Giadom to be national chairman of di party.

Di situation come even worse wen some govnors begin to beef Oshiomhole sake of di way e fight Govnor Godwin Obaseki during di party primaries for Edo state.

Sources tell BBC Pidgin say many of di northern govnors bin para and feel say e no dey lead di party well.

But oga Garba Shehu say na media dey manufacture di controversy and dat make di media stop to interpret wetin no dey.

According to di party constitution, na only di national executive committee or di national convention of di party members fit to solve dia katakata wey dey tear di goment party apart.

So as tins be so, e dey safe to say na Victor Giadom be di duly recognise acting national chairman of di APC, by Nigerian law.

But, some members of di National Working Committee (NWC) still believe say di Nigerian President recieve wetin dem call ‘wrong advice’ or ‘blackmail’ to throw im weight behind di National Executive Committee meeting wey Victor Giadom say go happun on 25 June, 2020.

Di APC dey face di risk of losing two states govnorship elections wey go happun for Edo and Ondo state if dem no solve di crisis.

Wetin give Giadom power as APC Acting National Chairmo?

Tori say Victor Giadom declare im sef national chairman of di ruling APC based on Abuja High Court order of March 16, 2020 no be news again.

But how Giadom take land for di centre of dis party politics?

BBC Pidgin Daniel Semeniworima find out say some of di top positions for di party bin dey vacant during di time wey di FCT High Court order Giadom to take charge of di party for March 2020 and Appeal Court come press hand ontop di matta for June 2020.

By di time di order come, di NWC wey national chairman Adams Oshiomhole dey don suspend di deputy national chairman north, di deputy chairman south dey vacant becos di last official, Niyi Adebayo, don become minister of di federal republic and di south west wey dem zone am too neva fill di position.

And den di national secretary position too dey vacant becos Mai Mala Buni, go become govnor of Yobe state for northeast Nigeria, so di only senior na di deputy national secretary wey bin dey act as national secretary. In terms of seniority, Victor Giadom na di most senior officer so im come become acting national chairman.

For pesin wey no bin dey really follow Edo politics before dis time, plenty kwesions fit dey im mind unto how di katakata for di party take reach wia e dey today.

For some time now, Oga Adams Oshiomhole AKA ‘Oshio Baba’ for short and di state govnor Godwin Obaseki bin don dey get kwanta unto who dey run di state.

Kasala burst for di state APC for June 2019 afta nine out of 24 State House members gada dem sef elect principal officers for di Edo State House of Assembly. Oshiomhole bin no like di result of di election.

Di kwanta enta anoda level wen on Tuesday 12 of November 2019, APC chairman from 18 local goments areas of Edo state suspend Adams Oshiomhole as dem pass vote of no confidence on top.

Beginning from Oshiomhole ward, ward 10 of Etsako Local Goment Area, to di local goment proper reach state levels, di party ratify im suspension according to di law.

Based on di ratified suspension, for January 2020, di deputy chairman of di party for North East, Comrade Mustapha Salihu plus odas file ex-parte application before Justice Danlami Senchi of Federal High Court, Abuja make Oshio Baba stop to dey parade imsef as di national chairman of APC.

On March 4, Justice Senchi wey grant di order say political parties must to obey dia constitution, and as im don chop suspension from im ward Oshiomhole no suppose dey work as party chairman.

Victor Giadom Biography: Who be and where Victor Giadom from to be di APC Acting National Chairman?

Victor Giadom

BBC

Victor Tombari Giadom, KSC na politician, wey come from Gokana Local Goment Area for Rivers state, southern Nigeria.

For 2017 na im Giadom first join di APC National Working Committee as Deputy National Secretary. By 2019 e become Acting National Secretary of di goment party as e be say di pesin wey bin dey di post collect political appointment.

Oga Giadom na im bin serve as di chairman of di govnorship campaign team for 2015 election for All Progressive Congress for Rivers State.

Victor Giadom wey be Knight of Saint Christopher for church, bin serve as Commissioner for Works under Govnor Amaechi between 2011 and 2015.

For 2019 im act as di running mate alias Deputy Govnorship candidate to APC Tonye Cole for Rivers State Gubernatorial election but court dismiss di ticket say APC no fit contest dat election for Rivers State.

Na afta dat election na im Giadom return back to APC National Secretariat as Acting National Secretary until March wen im ask court to declare am di Acting National Chairman of Nigeria ruling party.

Di next challenge wey dey road na to see how dis Rivers politician go fit manage di goment party wey get plenti court cases and crisis amongst members plus keep di APC intact to fit win di 2023 election circle.