Edo PDP primary: Court strike out Godwin Obaseki and Omoregie Ogbeide-Ihama case

Di Federal High Court for Port Harcourt don strike out di case wey one of di PDP governorship aspirant for di Edo state gubernatorial election Omoregie Ogbeide-Ihama bring.

Justice Emmanuel Obile strike out di matter after di lead lawyer to Ogbeide-Ihama, Donald Den Nwigwe (SAN) apply for withdrawal of di matter.

Special adviser to Edo state govnor for media and communications strategy, Crusoe Osagie, bin tell BBC say di suit to stop Edo state Govnor Godwin Obaseki to participate for di opposition Peoples Democratic Party primary no go stand as e dey against im right to freely associate.

Dis dey follow di out of court resolution by parties for di case.

Hours earlier, di federal high court bin stand down till 2:00pm for parties to settle out of court for di case of Edo state PDP governorship primary election wey go hold for Thursday, 25th June, 2020.

Di governorship aspirants of the PDP, Omoregie Ogbeide-Ihama, bin drag di National chairman of PDP, Prince Uche Secondus, Emmanuel Ogidi and seven odas because dem allow Obaseki or any member of di party wey buy forms but dem no screen dem within di stipulated time frame for di timetable to contest di PDP primary.

Omoregie Lawyer, Fredinard Orgbe before di hearing for di application of injunction start,  ask di court to stand down for hours so di parties fit tidy up di terms of settlement.

Lawyers to all di defendants also agree with di request and no oppose di application for settlement

Di presiding Judge, Justice Emmanuel Obile, grant di prayers come stand down in di interest of peace.

Oga Osagie say, e no dey possible for anybody to say im dey vex becos Govnor Obaseki join PDP becos di govnor move to contest primary for PDP, dem do am according to di rules and law and principles of di party.

“As long as im no break di law of di constitution, e no get any reason for anyone else to disrespect anybody right.

“Di waiver wey di govnor get follow all di due process according to di constitution of di PDP to give am di waiver, if you tok of im joining di party, dem make sure say dem follow di rules of di party to add am for di party. So im no break any PDP constitutional rule and dat na why we know say di court go troway di decision, im tok.

Di order of di Federal High Court for Port Harcourt to hear di suit wey wan stop Obaseki come, afta PDP govnorship aspirant and di House of Representative member wey dey represent Oredo Federal Constituency, Omoregie Ogbeide-Ihiama,file suit make Obaseki no follow do di party primary wey go happun on June 25, 2020.

Im say only those wey buy form during di timeframe di party bin lay down suppose dey allowed to participate for di primary.

Justice Emmanuel Obile, bin move di case to June 24 for hearing.

“We believe dem go allow di law to take im course and wen dat one happun, dem go allow my govnor to exercise im right. I mean im na citizen of dis kontri and im dey free to associate wit any group as long as im do am according to di law wey rule dat group,” Oga Osagie tok.

Govnor Godwin Obaseki port go PDP on Friday 19 June, afta im formally announce im decision to resign as All Progressive Congress party membership on Tuesday 16 June.

We don update dis tori.