Obaseki react to court ruling wey say make im no contest inside PDP primaries for Edo state

Godwin Obaseki

Getty Images
Edo Govnor, Godwin Obaseki dey find second term

Special adviser to Edo state govnor for media and communications strategy, Crusoe Osagie, say court decision make governor Godwin Obaseki no go stand as e dey against im right to freely associate.

Oga Osagie say, e no dey possible for anybody to say im dey vex becos Govnor Obaseki join PDP becos di govnor move to contest primary for PDP, dem do am according to di rules and law and principles of di party.

Dis reaction dey come afta one federl;a high court for Port Harcourt, Rivers state stop di Edo state govnor from participating in di PDP govnorship primary election.

“As long as im no break di law of di constitution, e no get any reason for anyone else to disrespect anybody right.

“Di waiver wey di govnor get follow all di due process according to di constitution of di PDP to give am di waiver, if you tok of im joining di party, dem make sure say dem follow di rules of di party to add am for di party. So im no break any PDP constitutional rule and dat na why we know say di court go troway di decision, im tok.

Di govnor lawyers don already dey try solve di mata of di High Court decision.

Federal High Court for Port Harcourt grant di prayer of Peoples Democratic Party (PDP) govnorship aspirant and di House of Representative member wey dey represent Oredo Federal Constituency, Omoregir Ogbeide-Ihiama, make Obaseki no follow do di party primary wey go happun on June 25, 2020.

“We believe dem go allow di law to take im course and wen dat one happun, dem go allow my govnor to exercise im right. I mean im na citizen of dis kontri and im dey free to associate wit any group as long as im do am according to di law wey rule dat group,” Oga Osagie tok.