Ibidun Ighodalo burial and night of tributes go happun live for TV according to Trinity House Church

On Saturday June 20, na im dem go bury Ibidunni Ighodalo, di wife of Lagos-based pastor and founder of Trinity House, Pastor Ituah Ighodalo wey die for Port Harcourt.

Tori be say na few family members and friends go attend di burial.

But di church announce say dem go show di service live for Arise TV for DSTV channel 416 by 2pm (WAT) and stream for dia social media platforms Facebook, Twitter, Instagram and Youtube.

Di Church also say Friday na Night of Tributes for di late pastor wife wey go start by 6pm (WAT) and e go dey live on AIT DSTV channel 253.

Na on Wednesday, 17, June, 2020 friends and family gada for di service of songs.

For di event, her daughter sing worship song while Pastor Ituah Ighodalo wey wear white also participate for di emotional worship.

Ibidun Ighodalo

BBC
Late Ibidun Ighodalo family don open condolence register on Monday for dia domot inside Ikoyi.

Popular gospel artiste Tope Alabi na also one of di worshippers wey sing for di service.

https://www.facebook.com/bbcnewsyoruba/videos/3179815042129497/

Di sudden death of Ibidun on 14 June, 2020 shock pipo across di kontri and abroad.

Pictures from di service:

Tributes begin dey pour in as di deadi bodi of Ibidun Ighodalo arrive Lagos afta her sudden death for Port Harcourt.

Di family of di late Ibidun Ighodalo bin carry her bodi go mortuary for Lagos Island, according to di General Manager of Elizabeth R wey be madam Ighodalo company.

Im say dem bin carry di bodi go di mortuary in di company of her husband, Pastor Ituah-Ighodalo and oda family members.

Tori be say madam Ighodalo, di former Nigerian beauty queen wey be wife to Pastor Ituah-Ighodalo of Trinity House church for Lagos, Nigeria, die on Sunday for her hotel room for Port-Harcourt, Rivers State southern Nigeria.

“All I know be say she go to bed last night but no wake up again dis morning” Lawal Nurudeen her colleague wey be Manager of Elizabeth R (her company) tell BBC Pidgin.

Ibidunni Ituah-Ighodalo

Ibidunni Ituah-Ighodalo
Ibidunni Ituah-Ighodalo na im win Miss Lux wen she be 18 years old undergraduate for University of Lagos

Oga Nurudeen wey travel wit her to Port Harcourt for official project say she die on Sunday morning inside her hotel room.

Evriday Nigerians dey also feel di pain of her death

Tribute from oda Nigerians dey also enter for her in celebration of her life and ogbonge work. Pipo dey tok of di kain pesin wey madam Ighodalo be during her life:

Lagos state Governor Babajide Sanwo-Olu bin express shock wen im hear di news say Pastor Ituah Ighodalo wey im call im padi, lose im wife. Di Governor say madam Ighodalo na inspiration to many pipo.

Governor Sanwo-Olu dey pray wit family and friends of Pastor Ituah

Babajide sanwo-olu

Former Vice president of Nigeria Atiku Abubakar also follow choke mouth say even tho her life fit don dey short, e bin get impact.

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/photos/a.860158887523172/1520989091440145

Ibidunni Ituah_Ighodalo

TY Bello

Until her death, di former Miss Lux bin dey run Ibidun Ighodalo Foundation.

Na for February, di mother of two mark her 13th wedding anniversary wit her husband, Pastor Ituah Ighodalo of di Trinity House.

Di 39 year old former Nigerian beauty queen, wife and head pastor of Trinity House church, be businesswoman and marriage counsellor wey set up NGO foundation to give support to couples wey dey find pikin to born.

At about 1pm on Sunday, 14 June, di Instagram page of her church post black foto, wey fit mean say true-true dem don suffer big loss.

And her personal Instagram page wey up until di time tori break of her death get 76,000 followers, don dey closed down.

https://www.instagram.com/p/CBagO7bFN7c/

Her family don confam di death of di former beauty queen for statement wey Asue Ighodalo sign. Di family also tok say dem go share informate of her burial as time go on. But dem no mention di cause of death.

https://www.instagram.com/p/CBbIAcdDb0w/?utm_source=ig_web_copy_link

See some tins wey you fit no know about her

  • Wen she be 18-year-old undergraduate of University of Lagos, Ibidunni nee Ajayi, win Miss Lux beauty pageant.
  • She be di founder of Ibidunni Ighodalo Foundation, di NGO wey dey raise awareness on infertility mata.
  • For one 2018 interview, Ighodalo tok say she bin do IVF 11 times due to pressure from in-laws and friends.
  • She bin dey run one of di successful event planning company – Elizabeth R – wey dey decorate Lagos during Christmas.