Katsina attacks: Demonstration against killings for di north happun for Buhari state

Many youth groups don enta street for Katsina, norh west Nigeria to protest wetin dem call di kili-kili and insecurity wey dey happun for di region.

Dis an di fourth protest wey dey happun in two weeks for di state.

Dis latest protest dey come three days afta di attack for Faskari wey kill at least 20 pipo.

Youths with di coalition group wey organise di protest carry different placards some of dem wey say”Arewa is bleeding”.

Tok-tok pesin for di group Abdulaziz Sulaiman yan say dem no fit siddon dey look while insecurity dey take northern Nigeria with kili kili everywia.

“We dey protest di killings happening for Nigeria and we wan goment to act fast because di thing don reach boiling point.”

Just six days ago, bandits kill many pipo for Kadisau town including di town chief after dem open fire on dia arrival.

Anoda one wey happun for Faskari town 7 days ago leave over 20 pipo dead and oda 26 pipo injure according to state police command.

CNG tok tok pesin Abdulaziz add say di protest wey hold for Katsina and di ones wey go follow am for oda 19 northern states mean say ‘enough is enough’ and goment suppose act.

Abdulaziz say dem go continue to protest until things change and hopefully goment go listen to di cries of northern Nigerians over dis mata.

No be today northern Nigeria start to suffer from dis kili kili wahala, from Boko Haram wey dey disturb North Eastern Nigeria to bandits wey dey kill and steal cattle for Northwest Nigeria.

Di Nigerian states wey dis issue dey disturb pass na Borno, Katsina, Zamfara, Sokoto and Kaduna states.

Two oda times wey northerners protest against Buhari goment

Yantumaki protest– Dis one happun on di 10th of June 2020 for Yantumaki town wey dey for Dan Musa local goment for Katsina, northwestern Nigeria wey be home town of Nigerian President Muhammadu Buhari.

Di protest na over di kili kili wey happun for di town and oda neighbouring towns for di state wey also lead to di kidnap of one health worker Yusuf Mansur and im daughter.

Protesters burn billboard wey carry President Buhari poster and also that of govnor Aminu Masari of Katsina state.

Yankara protest– Dis also happun for Katsina on June 11 2020 after pipo of Yankara town come out to protest after bandits attack Faskari town wia about 40 pipo die.

Di protesters block di popular Sokoto to Zaria highway, wia some of dem carry posters of President Buhari and govnor Masari, dem call on dem to act fast on di security situation.