Oluwatoyin Salau: Tallahassee Police find Toyin Salua dead bodi afta twitter complaints before she miss for Florida city

Police don find Oluwatoyin Salau deadi bodi days after she bin miss, according to wetin BBC Pidgin fit verify.

‘Toyin’ for short, na 19 year old US based Nigerian wey be activist and she follow do Black Lives Matter march for Florida, USA.

BBC Pidgin find out say di Tallahassee Police Department bin declare her missing on 9 June, 2020 but days later dem declare her dead on Monday evening 15 June afta dem find her deadi bodi in a case of homicide wey dem dey investigate.

Tori be say di 19-year-old activist bin miss afta she post complain for Twitter say pesin sexually assault.

According to di police report, at about 9:15 pm Saturday night, 13 June, 2020, TPD investigators arrive for 2100 block of Monday Road to follow up investigation wey concern one missing pesin (referring to Oluwatosin Salau) case.

During di investigation, two dead bodi tanda for di area, di statement add. Police say dem find her bodi wit one oda 75-year-old woman.

Dis na Oluwatoyin last complain before police find her deadi bodi;

Oluwatoyin Salau na prominent voice in protests over police brutality. Dem also identify suspect wey di police say dey dia hand now.

As di investigation continue, investigators develop a suspect. Police say suspect dey in custody now and no more information dey available for now.

Di deaths Oluwatosin Salau and di 75 year old woman, police say dem dey investigate di mata as homicides and dem don hand over to di TPD Violent Crime Unit.

Investigators dey ask anyone wit information about dis case to call dem on; 850-891-4200 or Crime Stoppers at 850-574-TIPS.