
More tributes dey pour in as di deadi bodi of Ibidun Ighodalo arrive Lagos afta her sudden death.
Di family of di late Ibidun Ighodalo don carry her bodi go mortuary for Lagos Island, according to di General Manager of Elizabeth R wey be madam Ighodalo company.
Im say dem bin carry di bodi go di mortuary yesterday in di company of her husband, Pastor Ituah-Ighodalo and oda family members.
Tori be say madam Ighodalo, di former Nigerian beauty queen wey be wife to Pastor Ituah-Ighodalo of Trinity House church for Lagos, Nigeria, die on Sunday for her hotel room for Port-Harcourt, Rivers State southern Nigeria.
“All I know be say she go to bed last night but no wake up again dis morning” Lawal Nurudeen her colleague wey be Manager of Elizabeth R (her company) tell BBC Pidgin.

Oga Nurudeen wey travel wit her to Port Harcourt for official project say she die on Sunday morning inside her hotel room.
Di 39 year old former Nigerian beauty queen, wife and head pastor of Trinity House church, be businesswoman and marriage counsellor wey set up NGO foundation to give support to couples wey dey find pikin to born.
At about 1pm on Sunday, 14 June, di Instagram page of her church post black foto, wey fit mean say true-true dem don suffer big loss.
And her personal Instagram page wey up until di time tori break of her death get 76,000 followers, don dey closed down.
https://www.instagram.com/p/CBagO7bFN7c/
Her family don confam di death of di former beauty queen for statement wey Asue Ighodalo sign. Di family also tok say dem go share informate of her burial as time go on. But dem no mention di cause of death.
https://www.instagram.com/p/CBbIAcdDb0w/?utm_source=ig_web_copy_link
- Sushant Singh Rajput don die – Many suspect suicide, see movies wey make am popular
- Edo Govnor Godwin Obaseki go visit Nyesom Wike for PH

Evriday Nigerians dey also feel di pain of her death
Tribute from oda Nigerians dey also enter for her in celebration of her life and ogbonge work. Pipo dey tok of di kain pesin wey madam Ighodalo be during her life:
Lagos state Governor Babajide Sanwo-Olu bin express shock wen im hear di news say Pastor Ituah Ighodalo wey im call im padi, lose im wife. Di Governor say madam Ighodalo na inspiration to many pipo.

Former Vice president of Nigeria Atiku Abubakar also follow choke mouth say even tho her life fit don dey short, e bin get impact.
The life of Pastor (Mrs) Ibidun Ituah-Ighodalo, late wife of Head Pastor, @trinityhouseng, Pastor Ituah Ighodalo, may have been short, but it was impactful.
— Atiku Abubakar (@atiku) June 14, 2020
Her Ibidunni Ighodalo Foundation (IIF), a non-profit organisation was a source of blessing to many women. My deepest condolences to the Ighodalo and Olaleye Ajayi families. May her soul rest in peace. -AA
— Atiku Abubakar (@atiku) June 14, 2020
https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/photos/a.860158887523172/1520989091440145
Life! Ibidun Ighodalo?
Just gone ……. like a candle in the wind.
Too much of a heartbreaking news.
May God comfort our very dear Pastor Ituah and rest of family in the way that only He can in Jesus name. 😭😭 pic.twitter.com/Dg57xkat44— Oby Ezekwesili (@obyezeks) June 14, 2020
Unbelievable! Ibidun. .Dead??My own dear Sister. I am still hoping I will be told it’s not true!!!!! pic.twitter.com/QPpkdZPLD6
— Abike Dabiri-Erewa (@abikedabiri) June 14, 2020
Ibidun ighodalo is one lady that is beautiful inside and out. She is so talented, soft spoken and kindhearted.
May her soul rest in perfect peace. 💔😢 pic.twitter.com/U2laGKez0G— Your Favorite Event Planner 🥰 (@oreke_lewa) June 14, 2020
Thank you for your amazing contribution to the event industry and the life of women with infertility issues. We appreciate you. Rest In Peace Ibidun Ighodalo pic.twitter.com/ZgQjjAc1xW
— 별 (@theoraysomoye) June 14, 2020
Breaking: The beautiful wife of Pastor Ituah Ighodalo, who pastors The Trinity Church.
Mrs Ibidun Ighodalo was reported to have died of cardiac arrest this morning around 2am.This video was shot early last week. As if she knew, her time is up😭😭😭#RIP pic.twitter.com/z5o2V3A9DA
— #BLACKLIVESMATTER ®🇳🇬🇨🇦🇬🇭🇺🇸🇬🇧 (@tholuinspire) June 14, 2020
Until her death, di former Miss Lux bin dey run Ibidun Ighodalo Foundation.
Na for February, di mother of two mark her 13th wedding anniversary wit her husband, Pastor Ituah Ighodalo of di Trinity House.
See some tins wey you fit no know about her
- Wen she be 18-year-old undergraduate of University of Lagos, Ibidunni nee Ajayi, win Miss Lux beauty pageant.
- She be di founder of Ibidunni Ighodalo Foundation, di NGO wey dey raise awareness on infertility mata.
- For one 2018 interview, Ighodalo tok say she bin do IVF 11 times due to pressure from in-laws and friends.
- She bin dey run one of di successful event planning company – Elizabeth R – wey dey decorate Lagos during Christmas.