Burundi President don die – See wetin you suppose know about Pierre Nkurunziza wey rule for 15 years

Pierre Nkuruziza: Who be di 15 year president of Burundi?
The British Broadcasting Corporation

Burundi President Pierre Nkurunziza don die at di age of 55 afta im suffer cardiac arrest according to goment sources.

Dem admit am to hospital on Saturday afta im fall sick, im comndition improve but on Monday, he get cardiac arrest and efforts to revive am no suceed according to officials.

Burundi goment announce di death of President Nkurunziza through statement wey dem publish for dia official Twitter handle.

Goment announce seven days national mourning wey start from today Tuesday.

Oga Nkurunziza lead Burundi since 2005 and bin dey prepare to handover power to di newly elected president, Evariste Ndayishimiye on August 20, 2020.

Who be Pierre Nkurunziza?

Pierre Nkurunziza wey dem born 18 Demcember 1964, become president of Burundi for 26 August 2005 and remain president till im death.

Im rule di kontri for 15 years.

Before im election, im be Chairman of di National Council for Defence of Democracy – Forces for di Defence of Democracy.

For 2015, im party nominate am to contest for third term as president.

Di nomination cause katakata for di kontri for more dan two months as opposition argue say e dey illegal for am to run for third term. Plenty pipo die for di mata.

On May 13 2015, dem plan coup against am wen im travel out of di kontri.

Major General Godefroid Niyombare, one time Burundi military chief of staff and di kontri one time ambassador to Kenya, bin claim say im don take over Nkurunziza goment. But Nkuruziza’s followers for military say na lie. Di coup collapse.

Afta oga Nkurunziza change di kontri constitution, im run for president for di fourth term for May 2020 presidential election.

Later, im decide to retire wit di title of “supreme guide of patriotism.”

For im send off gift, Burundi parliament vote to pay am $530,000 plus luxury villa and lifetime salary wen im leave office.

Human right accuse

For 2019, one United Nations commission accuse im goment of human right abuse including killing pipo, unnecessary arrest, torture plus sexual abuse.

But di goment say all di accuse na lie.

For 2016, dem lock 11 pikin dem for prison sake of dem draw on top im pishure for dia school text book.

E happun again for March 2019, court for di kontri send three young girl go prison sake of say dem draw jaga jaga on top im pishure for dia schoolbook.

Last year, Burundi ban BBC from im kontri on top accuse say dem produce documentary wey damage di kontri reputation.