Update on airport reopening in Nigeria: See di latest rules wey passengers must obey to use five airports from June 21

Felix Akinbinu, Airport Manager, PH International Airport

BBC

Afta more than two months wey Nigeria goment close down all di airport for di kontri sake of coronavirus, domestic flights go resume for June 21.

Na five airports for di kontri wey goment give green light to begin operate commercial flight.

Di airport dem include: Nnamdi Azikwe International Airport Abuja, Murtala Muhammed International airport Lagos, Omagwa International airport Port Harcourt, Sam Mbakwe airport Owerri and Mallam Aminu Kano International airport for Kano.

But Nigeria airspace still dey closed to international flights.

See di guidelines wey passengers go follow wen airport open for Nigeria during di Covid-19 pandemic

  • Passengers must wear facemask to gain access to di airport terminal building.

  • Checking of passengers temperature by di appropriate authority dem
  • Airport authority don put marker for ground to guide passengers dem movement for wia dem go stand for any queue wen dem enta inside di airport
  • Di counters wia airline agents go attend to passengers go get transparent barriers to protect di stakeholders.
  • Afta di barrier any where passengers go, whether na screen or di departure lounge di marker for di ground go guide dia sitting arrangement, dis na to help dem know wia to sit or not.
  • Airport staff go guide passengers to make sure say dis rules no spoil.
  • At di point of boarding, airline go provide sanitizers for each passenger hands before dem enta di plane.