Justice for Uwa: Students protest murder of Uwavera Omozuwa for Benin

Na shout of “Say No to Rape” and “Justice for Uwa” na im pipo for Benin City, Southern Nigeria dey chant as dem protest go di Edo state police command.

Di students dey protest di killing of 22-year-old University of Benin student for inside Redeemed Church for Benin.

Di tori dey make pipo para for di kontri and begin dey demand for justice.

Di students wey carry placard dey sing I-no-go-gree songs say dem dey worry say rape don become very serious issue for di kontri and authorities no dey do anytin to stop am.

Early on, di Redeemed Christian Church of God don condemn wetin dem call di murder of Uwa afta dem attack am for inside one of di church branch for Benin, Edo state, Nigeria.

According to di statement wey di PRO of di church Olaitan Olubiyi sign, di church grieve and dey very disturbed about wetin happun.

Di statement wey also tok sorry to Uwa family add say Uwa na member of di choir for one of di parishes for Benin City and bin dey read wen di attack happun.

Dis wan dey come as di Governor of Edo state, Nigeria Godwin Obaseki don order police to ‘find, arrest and prosecute anybodi’ wey get hand for di death of Uwa.

Obaseki highlight say dem go use di Violence Against Persons law wey dey in full effect for di state to investigate wetin really happen and show di pesin wey dey behind di action, pepper.

Police bin tell BBC Pidgin say di rape accuse wey pipio dey spread ontop social media concerning di death of one 22-year-old for Benin, Edo state Nigeria dey wan kain.

PRO of di Edo Police Command, DSP Chidi Nwabuzor bin dey respond afta pipo begin react to di news of her death

Di life of di 22 year-old girl cut short afta she die on Saturday, May 30 from alleged rape wey happun inside one church for Ikpoba Hill, Edo state, Nigeria.

Tori be say Uwa, wey be first year Microbiology student for University of Benin, bin go read inside one Redeemed Christian Church of God near her house wen di rape happen, according to wetin her elder sister Judith Omozuwa tell BBC Pidgin.

Three days later afta di alleged rape incident, Uwavera die for hospital.

But police say dem dey treat di case as dat of two fighting.

“I bin call di DPO wey dey in charge of Ikpoba Hill area and im tell me say na case of fight between di deceased (Uwavera) and some jaguda pipo.

Im tell me say di fight bin happen inside di church before dem come rush her go hospital wia she finally die. Im promise to get more details and I dey wait for dat”, oga Nwabuzor tell BBC Pidgin.

Wen BBC Pidgin ask di Edo state PRO weda dem dey treat di mata as rape case, im say na (fight) na wetin di Ikpoba DSP tok.

Wetin Uwa family tok

BBC Pidgin reach out to Uwavera elder sister, Judith, wey give us di load down of wetin happen.

“My sister bin go church for morning to read. She dey always go dia to read even before she gain admission for University because e dey quiet.

Around afta 6pm, my mama receive call from one of di church members say make we come o say dem no know wetin dem do my sister. One of di women wey find my sister say wen dem see her, her skirt and pant don tear and her shirt dey soaked wit blood.

“Dem rape her”, Judith narrate wit tears wey full her eyes.

Listen to how Judith take narrate wetin happen to Uwavera:

Before Uwavera family members go reach di church, dem tell dem say dem don alredi rush her go hospital. Judith explain say na inside pool of blood di church security man, wey dey only start work by 6pm, see Uwavera.

From wetin Judith explain, nobodi including di security man bin dey di church wen di incident happen.

Uwavera bin dey on oxygen for three days but she no make am out of di hospital.

Di young Uwa bin plan to become Nurse for future but as she bin no fit get di course for University, she decide to read di Microbiology course wey UNIBEN give her.

BBC Pidgin bin try follow her mama and papa tok but Judith say dem still dey in too much shock to say anytin.

Di family no get any idea who dey behind di incident but dem dey demand for security agents to find who do am and punish dem.

Rape: How my step-father rape me for seven years’
The British Broadcasting Corporation

How pipo dey react to Uwa rape and death

As e be so, Nigerians don enta social media to para about di mata and demand justice from security agencies.

Career Coach Ogbeni Dipo tweet say Nigeria gats protect young girls for di kontri.

Singer DJinne dey put di blame on Nigerian parents wey im say don fail kpatakpata for di way wey dem dey raise dia male pikin dem.