Ese Oruru: Court sentence Yinusa Dahiru wey kidnap her to 26 years imprisonment

Federal High Court for Yenagoa, Bayelsa stat south south Nigeria, don sentence Yinusa Dahiru, wey kidnap 14-year-old Ese Oruru for August 2015 to 26 years in prison.Dis one na afta di court wey Justice Jane Inyang lead, find am guilty.Court convict Yinusa wey pipo dey popularly call “Yellow” on four out of di five count charges dem bin bring against am.

Justice Jane Inyang wey deliver di judgement free di accused on count one, come sentence am to five years on count two, seven years on count three, seven years on count four and seven years on count five on a jail term wey go run concurrently.Yinusa bin kidnap Ese Oruru, wey be teenager dat time come carry her go Kano State wia im marry her by force.Na February 2016 police rescue Ese afta dem arrest Yinusa, come charge am go court for March 2016 on five count charge of abduction, illegal sex, unlawful carnal knowledge, sexual exploitation and human trafficking.Di judgement don end four years of trial for di court.