Deaths in Kano: Wetin we know so far

Kano goment for northwest Nigeria don finally agree say plenti pipo dey die for di state.

Dem tok dis wan inside statement dem release on Sunday.

Commissioner of information Muhammad Garba na im write to tori pipo on behalf of goment and e tok say Govnor Abdullahi Ganduje don direct ministry of health to find out wetin lead to di high deaths rate.

Many pipo for Nigeria and beyond especially on social media bin dey para about di number of dead pipo wey many houses dey report from Kano.

Di goment say from di small investigation wey dem do, wetin dey cause di high death rate na malaria, diabetes, hypertension and meningitis and no be coronavirus as some pipo dey tink.

“We don close our borders, our state dey on lockdown and our pipo dey sanitize dia hands apart from dis new testing centre wey we dey plan with Bayero university go soon ready in two weeks.” Dis na part of wetin di statement read.

Isolation centre

BBC
Dangote don arrange six hundred bed isolation centre or Kano State

‘Pipo dey die’

12 big pipo for di state die on Sunday, 26 April, 2020, wey increase wetin pipo dey tok about weda na coronavirus especially as e be say no testing happun for Kano for three days.

One Salma Ahmed for her Whatsapp voice note wey go viral for di state say dem carry her pikin go different hospitals for di state wey no gree accept am and by di time dem carry am go Aminu Kano Hospital e die after small time.

Some of di pipo wey tok to BBC Pidgin about dia relatives wey die in di last one week tok say na either diabetes or heart problem make dem die.

Di World Health Organisation bin don warn say pipo wey get health complications dey at risk of di new coronavirus – meaning say dem dey more likely to die from di Covid-19 if dem catch di disease.

Abu Garzal wey im 92 year old papa die last week tell BBC say dem dey go hospital for di last four years on top im paralysis mata.

“For di past four years, we dey go hospital for im treatment but im situation worse recently and we carry am go hospital wia e die.”

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

Unlike wetin local media dey report, di latest coronavirus cases in Nigeria on Saturday 25 April, 2020 no plenti for Kano, north west region of di kontri.

Tori be say local media bin dey report say Kano govnor bin don announce 74 new cases of Covid-19 on Saturday, but inside di latest case wey BBC Pidgin obtain from Nigeria Centre for Disease Control, NCDC, na just four new cases dey Kano as at dat day.