As di coronavirus pandemic continue to dey spread for di world, state goments for different kontris don order compulsory use of facemask as measure to slow down di spread of di Covid-19 disease.
Although di World Health Organization tok say na only health workers, pipo wey dey treat Covid- 19 patients and pipo wey sick suppose dey wear facemask.
Di health join bodiinsist say pipo wey well no need use facemask. However, scientists for all ova di world say e no bad if evribodi begin dey use am as e dey safer to use, pass wen di face no dey covered wit mask for dis coronavirus period.
- ‘Lagosians must use face mask from now on or face di law’
- See correct tips parents fit use occupy dia children
- Lockdown in Nigeria: Wetin go happun next?
How to use face mask properly
Di World Health Organization advise say if you wan use facemask, den you must sabi how dem dey wear am and how you go fit troway am properly.
Di health body show five ways how you fit use facemask wey go work.
- Before you wear face mask, make sure say you use hand sanitizer wey get alcohol or wash your hands well-well wit soap and water.
- Cover ya mouth and nose wit di mask and make sure say no space dey between ya face and di mask.
- No begin touch di mask afta you don wear am. if you do mistake touch di mask, clean your hand again wit and sanitizer or go wash am wit soap and water.
- Once di face mask don wet wit heat, comot am and use new one. Dem no dey reuse single facemask.
- To remove your mask: Comot am from back (No touch di front mask), troway am sharperly inside dustbin, clean your hands again wit hand sanitizer or wash am wit soap and water.
Lagos and Osun states, south west Nigeria don become di latest states for di world to make am compulsory for use of face mask for all dia residents before dem enta public space.
- “No take disinfectant for Coronavirus”
- Workers suppose collect salary during coronavirus lockdown?
- Lockdown in Nigeria: Wetin go happun next?
Di states follow afta Germany, Republic of Czech, Australia, Morocco, Turkey, Slovakia, Poland, Jamaica, Bosnia and Herzegovina wey don give order say make nobody comot for house witout facemask.
In his quest to rid Lagos state of #COVID19 infection, #COVID19Lagos Incident Commander and Governor of Lagos @jidesanwoolu has demonstrated leadership with the use of locally made facemask.@drobafemihamzat @NCDCgov @NigeriaGov @SegsDr @followlasg @JokeSanwoolu @WHONigeria pic.twitter.com/zMvmQPGkzh
— Prof. Akin Abayomi (@ProfAkinAbayomi) April 23, 2020
Even di Nigeria Presidential Taskforce on Covid- 19 for one of di recent media briefing bin encourage all kontri pipo to begin dey use facemask if dey wan comot for house.
According to di latest data wey di Nigeria Centre for Disease Control release for 24 April, di kontri get 1, 182 confamed cases of coronavirus, 35 deaths and 222 don dey discharged.