Latest coronavirus cases for Nigeria: Di kontri record don pass 1000, Lagos get 80 new cases

Latest coronavirus cases in Nigeria on Friday 24 April reach 1095 wit di highest Covid-19 confam case for Lagos wey record 80.

According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give around 11:30pm, di kontri record 114 new confam cases of Covid- 19 disease and e don enta 27 states of di federation and di federal capital territory.

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 22nd APRIL 2020

  • Total Confirmed cases – 1095
  • Discharged – 208
  • Death – 32

For inside dis new breakdown

80 fresh cases dey Lagos meaning say Lagos alone don get total of 657 cases

21 fresh cases for Gombe

5 fresh cases for FCT

2 fresh cases for Zamfara

2 fresh cases for Edo

1 fresh case for Ogun

1 fresh case for Oyo

1 fresh case for Kaduna

1 fresh case for Sokoto