Coronavirus update: Nigerian states wey never get confam case of Covid-19 – How dem dey prevent am?

COVID- 19

Getty Images
COVID- 19

As at January 12, 2020, na only China get confamed case of coronavirus but by January 13, di virus don become global problem, as kontris like Thailand, Japan, South Korea and America begin record dia first cases of di virus.

Afta den, di disease begin spread to oda part of di world, including Africa.

For now, more than 2.5 million confamed cases of Coronavirus na im dey di world according to di latest data wey comot from Johns Hopkins Coronavirus Resource Center.

Nigeria bin record di first case of Covid-19 for February 27, afta one Italian man wey enta di kontri test positive for di virus.

For March 9, di kontri confam di second case, one citizen wey get contact wit di Italian man test positive.

Afta den, di kontri begin record more cases.

According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give, di kontri get 981 confamed cases of Covid- 19 and Lagos get di highest number with 582 cases.

Coronavirus don enta 27 states for di federation wit dis latest data.

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 23rd APRIL 2020

  • Total Samples Tested – 7153
  • Total Confirmed cases -981
  • Discharged – 197
  • Death – 31

States Affected

No. of Cases (Lab Confirmed)

No. of Cases (on admission)

No. Discharged

No of Deaths

Lagos

582

460

106

16

Abuja FCT

133

95

35

3

Kano

73

72

0

1

Osun

20

2

18

0

Edo

17

8

7

2

Oyo

17

11

5

0

Ogun

24

19

5

0

Katsina

21

20

0

1

Bauchi

8

3

5

0

Kaduna

9

5

4

0

Akwa Ibom

11

7

3

1

Kwara

11

9

2

0

Delta

6

5

0

1

Ondo

3

2

1

0

Enugu

2

0

2

0

Ekiti

4

1

2

1

Rivers

3

0

2

1

Niger

2

2

0

0

Benue

1

1

0

0

Anambra

1

1

0

0

Sokoto

1

1

0

0

Jigawa

2

2

0

0

Gombe

9

9

0

0

Borno

9

7

0

2

Abia

2

2

0

0

Adamawa

1

1

0

0

Plateau

1

1

0

0

Total

981

753

197

31

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

Di states wey Covid-19 neva enta

As di Coronavirus dey spread and kontris for the world dey record high numbers, about 10 states for Nigeria still dey free.

  • Ebonyi
  • Cross River
  • Kebbi
  • Imo
  • Bayelsa
  • Taraba
  • Kogi
  • Nasarawa
  • Zamfara
  • Yobe

Since di outbreak of coronavirus for di kontri, some of dis states don take some steps to ensure say di virus no enta dia states and dey don also prepare to contain di virus in case e happun.

For 21 March, Kebbi State say make all schools for di state close till further notice.

For 23 March, Ebonyi state goment ban all public gatherings, whether na wedding, burial, seminar, any tin wey go make plenty pipo gada.

Bayelsa and Imo state give order say from March 26 make all schools for di states close and dem ban public gatherings wey pass 50 pipo.

Cross River goment ban all religious gatherings wey pass more than 5 pipo.

Kebbi no gree make pipo comot or enta di state.

Taraba goment close all dia borders and restrict movement to enta or comot for di state.

Oda states for di federation wey get high number of confam cases na Lagos, Abuja, Kano and Ogun states. And these states don dey under lockdown for 14 days and oda states wey di virus don enta don put measures in place to take contain di spread.

Plateau don become di latest state to record one confam case of Covid- 19.


We don update this tori.