Chief of Defence Staff release names of terrorists behind Owo Catholic Church attack

Owo massacre

BBC

Di Chief of Defence Staff, General Lucky Irabor don release di names of suspects wey dey behind di attack on St Francis Catholic Church, Owo, South West Nigeria on June 5, 2022.

Di CDS during one press briefing say through collaborative efforts of di military and di DSS personnel, dem arrest four terrorists wey get hand for di attack for Eika, Okehi Local Government Area of Kogi state on 1 August, 2022.

Di suspects dem arrest na Idris Abdulmalik Omeiza (a.k.a Bin Malik), Momoh Otohu Abubakar, Aliyu Yusuf Itopa and Auwal Ishaq Onimisi.

The Defence Chief say preliminary investigation show say Idris Abdulmalik Omeiza na di mastermind of di terror attack on di Owo Catholic Church plus di attack of one Police Station for Adavi LGA, Kogi State on 23 June 2022. E kill one policeman during di operation and tiff plenty weapons.

“Through di collaborative efforts of military and DSS personnel, dem arrest four terrorists for Eika, Okehi LGA, Kogi State on 1 August 2022. Those dem arrest include; Idris Abdulmalik Omeiza (a.k.a Bin Malik), Momoh Otohu Abubakar, Aliyu Yusuf Itopa and Auwal Ishaq Onimisi.

“Di Defence Chief say  preliminary investigation show say Idris Abdulmalik Omeiza na di mastermind of di terror attack on di Owo Catholic Church plus di attack on one Police Station for Adavi LGA, Kogi State on 23 June 2022, wey lead to di killing of one  policeman and also tiff weapons.” E tok.

Security operatives for Nigeria don arrest suspects wey dey Link to di Owo Church Massacre.

Dis dey come two months afta di suspected terror attack wey happun for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo state Southwest Nigeria.

Di Chief of Defence Staff, General Lucky Irabor disclose dis on Tuesday during one parley with executives and editors of media organisations inside Nigeria.

General Irabor tok say dem arrest di attackers during joint operations wey involve di Armed Forces, Department of Security Services (DSS) and di police.

About 40 pipo die wen gunmen storm di church on June 5 and open fire on di congregation, plus also blow up one explosives as di worshippers before run for dia safety.

Oga Irabor tok say; “within di last time we meet, we don record remarkable achievement.

Make I bring am to your notice dat within di same period, men of di underworld don carry out ignoble actions wey don affect our collective well-being, namely di unfortunate train attack, di attack on Kuje correctional center and wetin dem don report for di past, di attack ond di presidential convoy.

 “Also, di Owo incident wey di plan na to bring man and women of di armed forces to present dem in a form and shape wey go make am look as if di nation dey on siege.

“We don arrest those behind di dastardly act for Owo.”

“Na my intention to present dem to di public, but because of di investigation wey still dey go on, I gatz to change my mind.”

“I go like to say in course, di world go see dem and odas wey dey behind oda daring attacks for di kontri.”

Wetin happun for Owo 5 June, 2022

Pipo of Owo for Ondo state southwest Nigeria no go forget Sunday 5 June anytime soon.

Dis na di day wen some unidentified gunmen enta di town and attack St Francis Xavier catholic church.

Di attackers bin enta di church afta dem throw dynamite, and start to shoot inside di church as service end, according to di leader of St Francis Church, Father Andrew Abayomi.

Afta dat, di state police commissioner order immediate deployment of armed and specialised policemen to di area to restore normalcy and fortify di entire community.

Ondo State govnor, Arakunrin Rotimi Akeredolu come declare seven day of mourning and say dem go hunt di killer down.

Nigeria President, Muhammadu Buhari, call di attackers “wicked pipo from di underworld” and add say, “no mata what dis kontri no go give in to evil and wicked pipo”.

Pope Francis, pray for victims of di attack say, “e entrust everyone to di Lord, dat God might send Im Spirit to console dem,”

Ondo state goment say di death toll from di Owo church attack rise to 40.

Names, faces of all 40 victims wey die for Owo attack

Here be a compiled list of di victims;

Owo church attack

BBC
BBC
Owo church attack

BBC
Owo church attack

BBC
Owo church attack

BBC

Who dey responsible for di attack?

Nigerian authorities say dem suspect say na di extremist group Islamic State West Africa Province carry out di deadly attack.

Nigeria Interior Minister Rauf Aregbesola disclose dis one afta one security council meeting wey President Muhammadu Buhari chair for di presidential palace for Abuja.

But no group don claim responsibility for di attack on St Francis Catholic church for Owo, Ondo state

If e dey confamed, e go be di first attack by di IS-linked militants for southern Nigeria – e signify how di violence don expand.

Di group dey mainly operate for di north of di kontri.