Police investigate suspected ‘abduction of kids’ for Ondo town

One case of suspected abduction inside Valentino area of Ondo town dey under investigation.

Na wetin Police for di South West Nigerian state tell BBC Pidgin on Saturday afternoon.

E follow reports of suspected minors for condition wey be like mass kidnap case for di area.

Police dey call for calm, make evribodi cool down allow dem investigate wetin really happun.

Funmilayo Odunlami, di Police Public Relations Officer say dem dey di area now to torchlight di mata.

Di State Criminal Investigation Department don take over di case, according to one tweet from di state police command.

DSP Odunlami say further information go dey communicated later.

Just last month gunmen storm one Catholic Church for Owo town  inside Ondo State come kill 40 worshippers and injure several odas.

Authorities never arrest anybody wey dey in connection with di attack.

Dis na breaking tori, dey refresh dis page for more details…