Regina Daniels and Ned Nwoko welcome second pikin

Popular Nigerian actress Regina Daniels don deliver her second pikin for Jordan.

Senator Ned Nwoko wey be husband of di feem producer and model na im post for social media to announce say im wife Regina born baby number two same day wey dem dey celebrate dia first son birthday.

For di post, Oga Ned say, “ e be double celebration today for di family as Moon turn two years…. E be also delight to announce di arrival of our second son today.”

“Regina and di baby dey do very well for Amman Jordan. Uniquely Moon and im baby broda now dey share di same birth date. Di family dey over di moon, Oga Ned tok.

Two years ago, Regina Daniels born her first pikin. Dem name am Munir Neji Ned-Nwoko.

Dat time, di first time mama bin siddon wit BBC Pidgin to tok about her motherhood experience.