Wetin Nigeria law tok about to own a gun?

Man dey shoot gun

Getty Images

Di controversial order wey Zamfara state Govnor Bello Matawalle give im citizens to go buy gun, defend demsef against bandits and kidnappers don get many many different reactions, including question from Nigerians on weda e possible to own gun.

One of di questions from di mata na also about wetin Nigeria law tok about individuals getting dia own gun and also, which kain gun civilians dey allowed to own.?

Na on Monday, 27 June, di goment of Zamfara state order im state pipo make dem go buy gun for dia protection.

According to information wey di goment release, any individual wey wan obtain gun to defend diasef go first apply to di commissioner of police.Di police go carry out background check and oda necessary findings to confam weda di pesin deserve to own weapon.If di pesin pass di screening, police go now give am licence to own gun.

Di tori don spark different reactions from different quarters.

Wetin Nigerian law tok about ownership of firearms?

Nigeria gun law dey for di Firearm Act chapter 146 of Laws of di Federal Republic of Nigeria 1990.

Di Firearm Act make provisions for how to take own or carry plus deal in firearm or guns and ammunitions or bullets and missiles.

According to dis law, nobody fit carry any personal gun except im collect license from di Inspector General of Police (IGP).

Di IGP get di power to give or refuse to give dis license according to wetin di National Council of Ministers decide.

Based on dis law, e no be anybody right or entitlement to get.

“Subject to di provisions of subsection (5) of section 5 of dis Act, no person shall, as of right, dey entitled to di grant of any licence or permit under dis Act, and di authority wey get di function of granting such licence or permit fit without being bound to assign any reason, therefore refuse di grant of such licence or permit or, subject to di provisions of any regulations under section 33 of dis Act, fit impose such terms or conditions as e reason am, and fit revoke such licence or permit for such cause as e consider appropriate.

Section 7, subsection 2 (a- e) of di Act say:

Notwithstanding di provisions of subsection (1) of dis section, no licence or permit under di provisions of dis Act shall be granted if reason dey to believe say di applicant or holder of di licence-

 

(a)           dey under the age of seventeen;

(b)           dey of unsound mind;

(c)          no dey fit to have possession of di firearm in question on account of defective eyesight;

(d)          na pesin wey im habits no show self-control

(e)          don during di previous five years dey convicted of offence involving violence or di threat of violence.

Na so part of di law read.

Matawalle get power to give dis kain order?

Govnor Bello Matawalle order make im state citizens go buy dia own guns na notin but anytin for Nigeria law give am power to yarn dat kain tok.?

From di Firearms Act of di Federal Republic of Nigeria 1990, na only di president fit to give order on who fit or who suppose carry gun for di kontri.

Part II Section 7 subsection (1) of di Firearms Act say if anybody feel offended say di IGP no gree give give am license or permit, make e “appeal by writing to di president wey go act wit im discretion wey im decision go be final.”

Some reactions to Zamfara goment directive

Di Chief of Defence Staff,  General Lucky Irabor, for im reaction to Zamfara state goment directive say Govnor Bello Matawalle no get di power to instruct di Commissioner of Police of di state to issue gun licences to di public.

According to tori pipo Channels, General Irabor tok so for one interview on Monday for Abuja.

“I no tink say dat na di right way to go,” e tok. “Di basis for asking citizens to bear arms; I no know yet, I believe say di Attorney General of di Federation go look at di constitution, wetin di laws say and wetin di powers of di Executive govnor be to be able to do dis.” E tok.

Meanwhile, Barrister Wada Wada wey be legal expert for Nigeria, say di pronouncement wey Zamfara goment make, dey clash wit di kontri constitution becos na di goment work to protect and save lives and property of citizens.

According to di lawyer, wetin di state goment dey show be say dem don fail in dia responsibility.

“Nigerian constitution tok say na goment go protect lives and property of pipo, so to ask civilians to arm demsef dey show say goment don fail.”

Ali Galadima wey be retired soja and fight two wars during im time wit di military tell BBC Pidgin say di move to allow citizens own guns go backfire sharp sharp.

“Na very bad move and e go show you say di world no dey alright for now.

Na goment work to protect pipo and dat one no suppose change.”