UK Court remand Ike Ekweremadu, wife Nwanneka for ‘organ-harvesting plan’

Senator Ike Ekweremadu and Beatrice Nwanneka Ekweremadu go dey UK Police custody till 7th July.

UK Metropolitan Police cari di two Nigerians go Magistrates Court on Thursday afternoon ontop charges to harvest pesin organ

Di two Nigerian nationals appear for Uxbridge Magistrates’ Court for dia first court appearance on 23 June.

Prosecutor Damla Ayas tell di court say: “In respect of dis offence dem, di Attorney General approval dey required.

“And di Crown require 14 days for dem to get am.” Ayas tok.

Tori be say di majority of di allege offence bin take place inside di UK, di court hear.

Di defendants, wey dey married, regularly live in Nigeria but get family in London, dem tell Uxbridge Magistrates’ Court.

Based on di prosecutor argument, dem adjourn di case for 14 days.

Di defendants [Ike Ekweremadu and Nwanneka Ekweremadu] dey remanded in custody.

Dem go appear for di same court on 7th July 2022.

Na two days ago, on Tuesday 21 June, 2022, dem arrest di two prominent Nigerians.

How Met Police arrest Ekweremadu and im wife

60-year-old Ekweremadu and im 55-year-old wife chop di arrest afta investigation by di UK Metropolitan Police Specialist team.

Met Police tok for inside one statement wey dem share wit BBC Pidgin say:

“Beatrice Nwanneka Ekweremadu, 55 [born 10th Sepember, 1966] of Nigeria dey charged wit conspiracy to arrange/facilitate travel of anoda pesin with a view to exploitation, namely organ harvesting.

Ike Ekweremadu, 60 [born 12th May, 1962] of Nigeria dey charged with conspiracy to arrange/facilitate travel of anoda pesin wit a view to exploitation, namely organ harvesting,” di statement tok.

Met Police say dem don remand di suspects for custody and dem go appear for Uxbridge Magistrates’ Court later today.

Dem launch di investigation afta detectives dey alerted to potential offences under modern slavery legislation in May 2022.

Di Met Police say dem don safeguard di child and dem dey work closely wit partners for more support.

Dem no give di gender of di child wey di suspects won harvest im organ.

“As criminal proceedings don dey go on, we no go provide further details,” di Met Police tok.

Ike Ekweremadu na former Nigerian Deputy Senate President.

Di serving lawmaker na ogbonge politician for Nigeria and im don dey Senate since 2003.

Ekweremadu na from Enugu State and im serve as di Deputy Senate President for 6th, 7th and 8th Nigerian Senate.

Di Senator hold both bachelor’s and master’s degree in law from di University of Nigeria and dem call am to bar in 1987.

Wetin be organ harvesting?

Ike Ekweremadu, Nwanneka arrested for ‘organ-harvesting plan’: UK Court remand Nigerian Senator, wife

Getty Images

Organ harvesting essentially na ‘killing on demand’, dis na di selling and transplanting of organs of victims.

Na wetin international society for human right tok.

Dem say organ harvesting dey take place for various kontries for di world, especially in China, India, and on the Sinai Peninsula.

Organ harvesting simply mean di surgical procedure wey go illegally remove organs or tissues for reuse, mainly for organ transplantation.

Sometimes e dey happun against di will of di organ owner.

E also mean di removal, preservation and use of human organs and tissue from di bodies of di recently dead pesin to be used in surgical transplants on di living.

More on organ-harvesting dey here: Organ-harvesting meaning, victims & risk