Nigeria vs Sierra Leone highlight: Osimhen, Iwobi goals give Super Eagles win

Nigeria super eagles don top Group A of di African cup of Nations qualifiers, Afcon 2023 for Ivory Coast.

Dis na Eagles first win in five matches since dia embarrassing loss for Afcon 2021 for Cameroon and dia failure to beat Ghana to qualify for di Qatar World cup.

Leone Stars play Nigeria for di Moshood Abiola National Stadium inside Abuja on Thursday.

11th minute goal by Jonathan Morsay bin put Seirra Leone ahead but Alex Iwobi wit solo shot from di left wing help Nigeria equalise for di 16th minute.

On di 40th minute striker Victor Osimhen header put Nigeria for front.

Dis victory don reduce pressure on di Super eagles team and dia new coach Jose Peserio – na im first win since e take over di role from former coach Augustine Eguavoen.

Sao Tome and Principe as well as Guinea-Bissau na di oda teams wey dey for di Group.

Na only two of di four teams go qualify for Afcon 2023 for Ivory Coast.

Nigeria vs Sierra Leone highlight

Second Half:

45 mins: Nigeria 2-1 Sierra Leone

45 mins: Oghenekaro Etebo enta for Umar Sadiq

47 mins: Both teams don start on careful note. Dem dey watch dia sef

50 mins: Samuel Chukwueze try to lead counter attack but di Leone stars defenders stop am

53 mins: Chukwueze miss good scoring chance inside six yard box.

55 mins: Etebo dey control di midfield.

56 mins: Ekong stop Kamara fast run from di left side

58 mins: Substitution for Sierra Leone. Amaodu Bakayoko enta for Morsay

60 mins: Bakayoko wey just enta make immediate impact as e miss chance to score Sierra Leone second goal

62 mins: Di game dey balance so far. Bakayoko entry don increase pressure on Super eagles.

64 mins: Nigeria dey try find gap for Leone stars half.

66 mins: Ekong shoot di free kick wide

73 mins: Super eagles don take control of di game in di last five mins

75 mins: Victor Osimhen pressure goalkeeper Mohammed Kamara wey hit ball go off di pitch

79 mins: Nigeria defender Troost-Ekong don tear im tight

81 mins: 3 Substitution for Super eagles. Lukman enter for Chukwueze, Omeruo enta for Ekong and Shehu Abdullahi enta for Ola Aina

84 mins: Super get corner wey dem no fit convert into any tin.

86 mins: Yellow card for Nigeria goalkeeper Francis Uzoho for wasting time.

90 mins: Nigeria 2-1 Sierra Leone

First Half: Kick off

Nigeria 0-0 Sierra Leone

6 mins: Victor Osimhen miss good chance afta cross from Calvin Bassey

7 mins: Strong start from super eagles

9 mins: Osimhen shoot wide afta better through ball from Alex Iwobi from di mid field

11 mins: Goal! Nigeria 0-1 Sierra Leone. Jonathan Morsay score wit flying heading

15 mins: Super eagles get corner.

15 mins: Sierra Leone chance to score second goal afta dia shot hit bar.

16 mins: Goal! Nigeria 1-1 Sierra Leone. Alex Iwobi score wit solo shot from left wing

19 mins: Samuel Chukwueze effort go wide but Super eagles sustain play wit Osimhen cross

20 mins: Sierra Leone goal keeper Mohammed Kamara dey take treatment

22 mins: Calvin Bassey dey overlap too much from di left wing

24 mins: Sierra Leone midfielder Toure dey stop most long balls from Super eagles

26 mins: Despite Nigeria domination Sierra Leone dey hold tight for defense

28 mins: Referee blow off side against Osimhen

35 mins: Sierra Leone hit long strike from outside 18 yard box

38 mins: Super eagles and Leone stars dey hold tin tight for di middle of di pack

40 mins: Goal! Nigeria 2-1 Sierra Leone. Victor Osimhen put Super eagles ahead wit good header

45 mins: Super eagles miss anoda good chance afta good low cross from Umar

Half Time: Nigeria 2-1 Sierra Leone

Nigeria vs Sierra Leone head to head

Nigeria Super Eagles neva win dia last five games.

E include loss for friendly games against Mexico and Ecuador just recently.

Di last time Nigeria win any game na dia 2-0 victory over Guinea-Bissau for di Afcon for January.

Meanwhile di Leone Stars win dia own friendly match against Liberia and Congo for March.

Dis na afta dem play two draws and one defeat for di Afcon for Cameroon.

Make you dey refresh dis page for live match updates from 5pm (Nigerian time)