APC Primaries: Governorship primary winners list

Di ruling All Progressive Congress (APC) dey conduct dia governorship primaries across Nigeria.

Di primaries hold for 28 out of di 36 states of di federation Wednesday 25 May ahead of di general elections wey go happun for 2023.

Officials of di Independent National Electoral Commission (INEC) monitor di exercise dem.

Security operatives also send dem to ensure say di primaries go smoothly.

See results from each state

Lagos State APC governorship candidate

Governor Babajide Sanwoolu of Lagos State, wey wan extend im tenure in office by anoda term win di primary election.

Im be di only APC candidate wey enta di race and im gbab all di delegates votes.

Di govnor don don thank di delegates and di leadership of di APC for di state for chance to continue im goment and context for di upcoming gubernatorial election..

Gombe State APC governorship candidate

Gombe State Governor, Muhammadu Inuwa Yahaya, emerge as APC governorship candidate for Gombe State.

Like Lagos State, di governor emerge unopposed as e be di only aspirant wey buy di nomination form and wey APC screen.

Nasarawa State APC governorship candidate

Governor of Nasarawa State Engr AA Sule don win APC Governorship Primary.

Im clear all 735 votes to beat Dr Fatima Abdullahi, di ex wife of di APC National Chairman, Abdullahi Adamu.

All di delegates from di 147 wards for di 13 Local goment vote for di incumbent governor to return am as di flag bearer of di party for di 2023 governorship elections for Nasarawa.

Borno State APC governorship candidate

Governor of Borno State Prof. Zulum win di APC governorship primary by 1411 Out Of 1411 votes.

Gov Zulum dey seek re-election for a second term in office.

Ogun State APC governorship candidate

Ogun State Governor Dapo Abiodun on Thursday win di All Progressives Congress’ governorship primary wit 1,168 votes to defeat five other aspirants.

Di incumbent govnor contest di election wit five other aspirants: Abdulkabir Adekunle Akinlade; Biyi Otegbeye; Modele Sarafa-Yusuf; Owodunni Opayemi and Remi Bakare.

Abiodun poll a total of 1,168 votes out of 1,170 delegates accredited votes to defeat other contestants wey score no vote.

Dem void two votes.

Delta State APC governorship candidate

Sen. Ovie Omo-Agege don win di Delta State APC governorship primaries with a total 1190 votes.

Sen. Ovie Omo-Agege na di Deputy president for di Nigerian Senate and rep, Delta Central Senatorial District.

Zamfara State APC governorship candidate

Governor Bello Matawalle of Zamfara on Thursday emerge winner of di All Progressives Congress (APC) governorship primary election for di state.

Rivers State APC governorship candidate

Tonye Cole emerge as APC governorship flag bearer for Rivers state wit 986 votes

Total votes cast be: Michael West 43, Tonye Cole Patrick 986, Bernard Mikko 2, Magnus Abe 1, Sokonte Davies 49, Ojukaye 190.

Abia State APC governorship candidate

High Chief Ikechi Emenike na im go represent di All Progressives Congress (APC) for di 2023 governorship polls in Abia state.

For di party’s governorship primary election wey happun for Umuahia, e poll 672 votes to defeat im closest rival, Hon. Emeka Atuma wey poll 150 votes.

Akwa Ibom State APC governorship candidate

Businessman and philanthropist, Obong Akanimo Udofia win di Akwa Ibom governorship primary of di All Progressives Congress (APC).

Although di primary election delay due to protests and logistics issues, e finish around 4am on Friday wen

Chairman of di Election Committee, Omoba Tunde Ajibulu announce results say Udofia get 1,227 votes to defeat prominent politicians such as Senator Ita Enang wey get 34 votes and Senator John Akpanudoedehe wey get 2 votes.

Cross River State APC governorship candidate

Senator Prince Bassey Otu win di Cross Rivers State All Progressives Congress( APC) governorship primary with 811 votes to defeat Senator John Owan wey get 84 votes and Chris Agara wey get 63 votes.

Prince Bassey Otu wey dem dey call “Sweet Prince’ bin don win di consensus vote but some of di aspirants insist say dem must test dia popularity.

Prince Otu represent Calabar South Senatorial District for di 7th National Assembly after im represent im constituency for House of Representatives.

Adamawa State APC governorship candidate

Senator Aisha Binani defeat former EFCC chairmo Nuhu Ribadu to get di APC govnorship ticket for Adamawa state wey dey northeastern Nigeria.

For di primaries wey hold on Thursday, Senator Aisha get 430 votes while Ribadu score 288 votes with former Govnor Jubrila Bindow wey come third with 103 votes.

She go contest di general elections against current Govnor Ahmadu Fintiri of di Peoples Democratic Party PDP as main challenger.

Kaduna State APC governorship candidate

Senator Uba Sani, di winner of di gubernatorial ticket for Kaduna State gbab 1,149 votes from delegates.

Sani, wey represent Kaduna Central Senatorial District for di National Assembly, defeat two other aspirants Bashir Abubakar, wey score 37 votes and Sani Shaaban wey get 10 votes for di contest.

We still dey put eye for dis tori, just dey refresh di page for more update…