Di Africa Magic Viewers’ Choice Awards (AMVCA) dey end on Saturday night wit di presentation of awards to winners.
Di eighth edition of di award ceremony go honour and recognize notable films and series of last year, along wit actors.
Di ceremony get week-long event wey dey end wit di award show.
Part of di highlight of dis year show na say e di organisers go give award to di Best Dressed Male and Female categories. Na di pipo wey attend di show go vote for di winners of dat category.
Celebrities especially actors don already begin arrive di venue and here na some of dia fotos;
Meaning of AMVCA
AMVCA na Africa Magic Viewers Choice Awards.
Di award na for ogbonge movies and actors for Africa.
Di award get several categories wey dem dey nominate actors or movies.
Part of di new inclusion for dis year na category wey dem create for pipo wey dey make skits dat na content creators.
Na fashion icons, Toke Makinwa, Ebuka Obi-Uchendu, Uti Nwachukwu and Sika Osei dey host dis year red carpet.