Chelsea vs Liverpool highlights: FA Cup final penalty shootout see Liverpool become champions

Tsimikas

Getty Images

Liverpool don win dia second title of di season as dem defeat Chelsea 6-5 on penalties.

Dis na di second time dis season wey Chelsea go lose on penalties to di side from Merseyside afta dem lose di Carabao Cup final for February.

Di Blues match Liverpool during regulation time but Alisson save from Mason Mount kick and Tsimikas conversion of im own kick guarantee Liverpool dia second trophy dis season.

Liverpool enjoy di better chances during di final, di outstanding Luis Diaz and Andrew Robertson hit di bar.

Liverpool now go get even more believe say dem fit win di quadruple as dem still dey in di race to win di league and also dey di final of di Champions League wia dem go play Real Madrid.

Di defeat na serious blow for Chelsea and manager Thomas Tuchel to lose in dis manner yet again as dem too bin get chances – Marcos Alonso hit di post and also see Alisson save im shot well – but dem become di first side to lose three successive FA Cup finals.

How di match go

Penalty shootout

Chelsea defender Alonso go take di first kick, im score Chelsea 1-0 Liverpool

Milner step up for Liverpool. Im score Chelsea 1-1 Liverpool

Azpilicueta na im go take next for Chelsea. Im miss Chelsea 1-1 Liverpool.

Thiago send Mendy di wron way. Chelsea 1-2 Liverpool.

James score for di Blues. Chelsea 2-2 Liverpool.

Firmino na im be next, im run stop run again before im shoot di ball past Mendy wey touch am small Chelsea 2-3 Liverpool.

Ross Barkley blast im kick past Alisson. Chelsea 3-3 Liverpool.

Now na di turn of Trent Alexander-Arnold, im send Mendy go di wrong way as im score. Chelsea 3-4 Liverpool.

Jorginho turn don reach, im score. Chelsea 4-4 Liverpool.

Mane dey up next, if im scor Liverpool don win di cup. Mane miss against im Senegal teammate. Chelsea 4-4 Liverpool.

Ziyech don step up to take for Chelsea. Di Moroccan blast im kick past Alisson. Chelsea 5-4 Liverpool.

Diogo Jota for Liverpool, score! Di Portuguese shoot right Mendy dive left. Chelsea 5-5 Liverpool.

Alisson save Mason Mount kick. Chelsea 5-5 Liverpool.

Now Liverpool need to score to win, Tsimikas to take, im score.

Liverpool win FA Cup 6-5 on penalties

Second half extra-time

Chelsea make two substitutions before second half extra-time start.

Loftus-Cheek and Azpilicueta don come on for Pulisic and Chalobah.

106 mins – Meanwhile Liverpool don restart di game.

108 mins – Chelsea want penalty as dem believe say Alexander-Arnold pull Ziyech back. Do ref wave play on.

111 mins – Liverpool take off Robertson, Kostas Tsimikas don come on.

115 mins – Di tempo of di game don drop as both teams don dey run out of gas.

119 mins – Lofrus-Cheek wey just come on go need leave di pitch as Ross Barkley don replace am.

120 mins – Penalties na im go decide dis game as e don finish Chelsea 0-0 Liverpool during regulation time.

First half of extra-time

Andrew Robertson (centre)

Getty Images

91 mins – Chelsea go get us underway for di first half of extra-time. If e end goalless afta extra-time di game go enta penalties to decide di winner.

Liverpool make substitution – Van Dijk off, Joel Matip on.

95 mins – Chelsea players and coach want penalty afta Pulisic go down inside di box wit claim say Matip foul am.

Di referee wave play on as VAR no call im attention to di incident.

98 mins – Roberto Firmino don come on for Diaz.

99 mins – Mount produce good moment but im final shot go di war most of di shot don go today – ova di bar.

105 mins – Some of di players look like say dem don taya but second of ext-time still dey for dem to play.

Second half update

Thiago

Getty Images
HERO

46 mins – Liverpool restart di second half and straight from dia Chelsea win di ball come create good chance.

First Alonso drag im shot from di right hand side wide den Pulisic test Alisson wit right foot shot.

Di Blues don start di second half well,

48 mins – Hit di bar! Alonso again go close to score wit freekick wey hit di crossbar.

51 mins – Liverpool full backs combine, Robertson fail to connect wit Alexander-Arnold cross.

52 mins – Diaz go close wit shot from outside Chelsea box. Di two teams don begin create chances.

So far Chelsea don take six shots (two on target), while Liverpool don shoot 10 times (only one on target).

60 mins – E be like nobody wan score today. Jota dis time shoot im shot wide of di post anoda good chance to open di scoring.

63 mins – Liverpool win back-to-back corner kicks but both times notin come out of dem as Chelsea handle di threat well.

65 mins – Thiago pick out Keita wit looped pass, di Guinean shot no trouble Menday as im catch am well.

66 mins – Substitution: Chelsea bring on Kant for Kovacic as coach Thomas Tuchel make im first sub.

68 mins – Anoda shot off target from Christian Pulisic. Di forward try to take James cross first time but im shoot wide.

69 mins – Diaz try to bend im righ foot shot past Mendy di ball go ova.

74 mins – Liverpool make dia second substitution as James Milner don replace Naby Keita.

77 mins – Reece James receive yellow card for late foul on Thiago.

83 mins – Diaz don hit Chelsea post! Di Liverpool forward collect pass from Mane, settly imsef well before im strike hit di post.

84 mins – Liverpool hit di post again, incredible! Dis time from Robertson wey connect wit Milner cross.

85 mins – Hakim Ziyech don come on for Romelu Lukaku.

90 mins – Referee don add three minutes before stoppage time. If e end goalless, dem go play extra time.

Full time – Chelsea 0-0 Liverpool.

First half update

Luis Diaz

Getty Images

1 min – Lukaku and Chelsea don start di final for di sunny Wembley stadium.

4 mins – Poor clearance from Mendy see Liverpool quickly work di ball ova to Luis Diaz wey see im cross-shot go past everyone. Trent Alexander-Arnold retrieve di loose ball come send left foot cross back in wey Salah head ova.

8 mins – Mendy produce good save to deny Diaz from opening di scoring as im save di Colombian shot wit im legs.

Diaz beat di Chelsea high line to run ontoo Alexander Arnold pass but im fail to punish di Chelsea defence.

12 mins – Chelsea look like dem dey boot as Liverpool players dey run di show. Dis time a couple of blocks deny di Reds from finding di target. Good defending by Chelsea.

17 mins – Kovacic try to break into Chelsea box wit good run wit di ball but Thiago bring am down.

Alisson comfortably catch di freekick wey Alonso tak wit im left foot.

22 mins – Pulisic go close to give Chelsea di lead. Di American run onto Mason Mount cut back but im fail to direct di ball goalwards as e roll harmlessly wide.

25 mins – so far di game dey goalless but Liverpool just camp for Chelsea half.

28 mins – Liverpool goalkeeper Alisson spread imsef well like butter inside bread as im stop Marcos Alonso from scoring. Di Spaniard leg brush di goalkeeper wey later need treatment.

30 mins – Alisson dey okay and di game don restart. Soon afta, Mo Salah go down and di doctors dey attend to di Egyptian.

33 mins – Salah no go fit kontinu, Diogo Jota don replace am as Liverpool make forced substitution.

40 mins – Mistake by Van Dijk see Chelsea Mount di ball off am. Di midfielder pass di ball to Lukaku wey try to send am back to Mount but Liverpool intercept and clear di ball.

42 mins – Konate try im luck from outside di box, im shot rise high and wide of Mendy goal.

45 mins – Jota miss good chance to give Liverpool di lead. Di substitute meet Robinson cross but loop di ball ova.

45+1 mins – Now na Lukaku turn to blaze im shot ova afta Jorginho knack am fine pass. We don enta four minutes added time.

Half time – Chelsea 0-0 Liverpool.

Chelsea vs Liverpool line up

Chelsea XI: Mendy, Chalobah, Silva, Rudiger, James, Jorginho, Kovacic, Alonso, Mount, Pulisic, Lukaku

Liverpool XI: Alisson; Alexander-Arnold, Konate, Van Dijk, Robertson; Keita, Henderson, Thiago; Salah, Mane, Diaz