ASUU Strike update: Academic Staff Union of University extend strike by 12 weeks

Di Academic Staff Union of Universities ASUU don extend dia strike action by 12 weeks starting from 12; 01 am on Monday, May 9, 2022.

ASUU presido, Emmanuel Asodeke wey announce di extension for press statement say di union take di decision afta di National Executive Council do one emergency meeting for dia secretariat for University of Abuja.

Oga Asodeke say afta dem extensively deliberate on goment intervention to end di strike action so far and discover say goment refuse to live up to im responsibilities to di issues wey dem raise for di 2020 FGN/ASUU MOU dem decide to roll over di strike to 12 weeks to give goment time to satisfactorily resolve all di outstanding mata.

Oga Asodeke say di union dey disappointed say di committee wey di federal goment set up to resolve di lingering strike wahala, neva call one single meeting till date.

ASUU dey also para say di only one meeting wey im member hold wit di Nimi Briggs re-negotiation committee no reflect di expected level of understanding, preparation and clarity wey reflect di collective bargaining.

Di lecturers explain say unless dem redirect di committee to conclude di draft agreement wey don dey ground since May 2021, dem dey waste time.

Di lecturers say dem condemn how goment dey wan use hunger to take break dia spirit as ASUU members make dem no fight for dia right and di right of universities dey counterproductive and e no go work.

Di lecturers say dem dey shocked say even though public universities dey under lock and key for three months now, politicians for di kontri dey buy nomination forms upandan wit plenti millions of naira while those wey dey power dey travel go Europe and America to go celebrate dia pikin dem graduation.

Di university lecturers argue say di way goment refuse to build di education sector na im make di kontri security architecture collapse and if dem no fix am quick, di kontri dey head to anarchy.

ASUU Strike – Wetin don happun so far?

Since di strike, delegation from both ASUU and goment don meet up to two times for di ministry of Labour and Productivity to iron out di issues and find solution to am.

On di 2009 agreement, di Minister of Education, Adamu Adamu don set up committee to re-negotiate di 2009 agreement between di federal goment and ASUU.

Di committee dey expected to turn in dia report in six weeks from di time of dia inauguration.

For 2009, di goment agree wit ASUU say dem go review dia condition of service everi five years .

Di condition of service include di salaries and allowances of di lecturers dem.

Anoda tin wey dem don chook eye on top na di review of di payment system.

Di Director-General of the National Information Technology Development Agency, NITDA, Kashifu Inuwa don tell tori pipo say di UTAS fail integrity test and dat dem dey wait for ASUU to upgrade dia payment system and send am back to dem.

Oga Inuwa say till date, ASUU neva return di upgraded version to dem to consider and certify weda e dey okay.

On earned allowance, di minister of Labour and Productivity say dem no get any problem wit dat one and dat wetin remain now na to reconcile di payment wey dem make to di university system in batch and afta dat one, di Minister of Finance go look for di remaining moni to pay even though di federal goment no get moni.

Nigeria Labour minister Chris Ngige also ask di Nigerian Labour congress to advise ASUU make dem call of strike as dem no give adequate notice before dem embark on strike wey dey against di trade Dispute Acts.

ASUU Strike Nigeria update: ASUU strike go end 9 May? as Education Minister beg workers

BBC

ASUU Strike Nigeria timeline from 2009 to 2022

Di Academic Staff Union of Universities, bin begin one month warning strike on February 14 2022 to demand for beta condition of service wey dem agree for 2009 agreement.

2020 ASUU Strike

Di union bin embark on nine-month strike sake of non-payment of allowances to lecturers wey no enrol under di goment payroll system, wey ASUU bin want replace wit dia own.

2018 ASUU Strike

One three-month strike bin happun sake of poor funding of education and increment of school fees wey goment bin plan.

2017 ASUU Strike

Afta dem sign anoda MOU in September 2017, di union bin suspend dia 36-day strike wey bin happun sake of allegations say goment fail to implement agreement from previous year.

2014 ASUU Strike

One week warning strike bin dey sake of say Nigerian goment no implement di 2009 agreement and one MoU wey dem reach for 2013.

2013 ASUU Strike

University lecturers bin go on strike for about six months as dem demand say make retirement age for professor dey extended to 70 instead of 65, and make goment increase allocation to education from 15% – 20% of di kontri annual budget.

2011 ASUU Strike

2009 agreement wey goment no meet na why di union bin go on a 59-day strike.

2010 ASUU Strike

ASUU bin go on indefinite strike in July 2010 wey last for over five months.

2009 ASUU Strike

Four months strike sake of 2007 agreement wey goment no meet wey involve demand for increase of budgetary allocation to education in Nigeria.