Osinachi Nwachukwu: ‘Peter tell my pikin say if she no go home alive, she go go in death’ – late singer mama

Osinachi Nwachukwu mama, sister and twin sister don speak for di first time since di talented gospel singer die on Friday, 2 April.

Inside interview wey BBC freelance tori pesin Hyacinth Ogbu do wit Osinachi family, dem share dia pain and tok about dia bad experience dem face wit Osinachi husband, Peter Nwachukwu.

Madam Madu, Osinachi mama as she dey express di pain for her heart say: “e dey pain me for di kain in-law wey dem cari come, di kain man wey marry my daughter Osinachi. Di kain tin I see for di man hand, I no sabi say dat kain tin dey dis life.

“Eva since im come marry her, my pikin no get peace, me sef no get peace.”

Osinachi mama say, afta her daughter marry, she no take eye see her pikin again until afta eight years. “Wen she born pikin, her husband no tell me say she don born pikin, na oda pipo tell me,” she tok.

At first, di talented gospel musician no gree tell her family wetin her eyes dey see inside her marriage.

Madam Madu say na outsiders bin dey tell her wetin her pikin eye dey see.

“Pipo dey gist me, my pikin no dey tell me wetin her eyes dey see, na outsiders dey tell me wetin my daughter eyes dey see.” She add say, “one pesin wey we bin dey live togeda for yard, 74 Nike road, wey dem follow her grow, call us say, if we sabi wetin we fit do for Osinachi mata, make we come do am.”

Osinachi finally call her family for help

Madam Madu say one day she receive call from her daughter- by dat time Osinachi just born pikin number three – say suffer don kee her, say nobody dey take care of her and wetin Peter dey cari her eyes see too much.

“She call her papa tell am say, wetin Peter tell her say say if she no go home alive, she go go in death.”

Dis tok make her eldest sister, Favour Mmadu, travel go Abuja cari Osinachi and her pikin back to her papa house for Enugu.

“Wit my moni, I go Abuja go cari Osinachi come back, I pay for her transport…”

She spend one year and three months for her papa house before Peter Nwachukwu come beg to cari im wife go home.

Madam Madu bin no want make her daughter go back to di marriage.

Di mother bin want her daughter to divorce and find anoda husband to marry.


Babatunde Kewejo no get legs but dey drive taxi for Ibadan
The British Broadcasting Corporation

“Osinachi open her mouth, I go tok true, she tell me say, ‘mama, God say wetin dem join togeda make no man put asunder, say she go go back. I tell her say make she no go back instead make she marry anoda husband. But she say no marry anoda husband, say she don marry, do wedding, no more separation.”

But wen Osinachi return to her marriage di husband begin abuse her all over again.

Favour, di elder sister say: “I call my sister: ‘Osinachi (you) and Peter no dey quarrel but stay on your own, make Peter stay on im own. No be say una dey qurrel but just make we see weda im head go correct.”

But Osinachi no take her sister advice, she remain for di marriage.

Osinachi beg Mummy Enenche for help

Although di ogbonge gospel musician born four children for her marriage, her mama no eva go visit her for Abuja, she no even go for ‘omuguo’.

“I no sabi wia dem dey live for Abuja. Di first pregnancy, I no go omuguo – wey bein wen psin mama go come live for di pikin house to help her take care of her baby – di second one, I no go.

E no want take eye see me and my family.”

She say di first time she go her pikin house na wen she bin sick well well.

“I come begin sick. Wen I begin sick, Osinachi go meet mummy Enenche – wey be di wife of di founder of Dunamis Gospel Centre Pastor Paul – beg her say wetin important to her na to take care of her mama and her husband no want make her mother come dia house.”

“Mummy Enenche go beg Peter, and e agree. Na only one month I stay for di house before im (Peter) pursue me and my son.”

Madam Madu lament her pikin marriage say wit di kain marry wey her daughter marry, e for beta for her say she bin no marry at all.

Peter no wan make Osinachi and I stand togeda – Amarachi, twin sister

Amarachi, wey be di late singer twin sister share some experience wey she bin face wey she attend one convention for Abuja.

She tok say she bin wan sing for stage wit her sister for di convention but her bin no wan di two sisters perform for stage togeda.

“My sister tell me say di two of us go sing togeda, we don sew cloth finish wey we go use…

Dat cloth we no wear am again, Peter no gree. Wen di day reach, I enta, sidon dey wait for my sister.

Di next tin, one broda Shango come tell me, ‘Mama,, hope you fit sing alone?’ I say yes.”

Amarachi tok say her brother-in-law bin drive come di front of (church) gate, drag her sister, spit and drag her enta motor and go lock her for house.”

Di twin say Osinachi no come again, na only her sing for di event.

Anoda experience according to Amarachi na wen dem go for church programme for Lagos.

Peter order di keyboardist make im no allow di two sisters near each oda for stage.

“Im no want make we stand togeda. If e be like say di two of us wan come close to each oda (for stage) di keyboardist go say, ‘mama shift, mama shift, I no want trouble.’ Everybody dey avoid am. Everybody dey avoid Peter.”

“Osinachi bin no wan marry Peter”

Peter Nwachukwu first see Osinachi for one glorious singers programme for Abuja wey she bin go wit her twin sister Amarachi Grace Eze.

Amarachi say Peter chase Osinachi tire, but her twin sister bin no gree for am.

“Peter Nwachukwu, wen im see us, e collect my number dey call, Osinachi no gree say Peter Nwachukwu go marry am. Osinachi refuse, she no gree. Peter Nwachukwu go dey call me for phone dey beg me, make I beg my sister to agree for am.

“I tell her say, Osinachi no understand dis man, as I dey see am so I no understand am but na your hand e dey. At a point e be like say everytin scata. Small time di man start again. How tins take happun las las na im I no sabi. But dem two begin relationship. Dem no do courtship, notin, dem no do anytin. Di next tin be say dem don agree.”

Everytin happun sharp sharp dem do all di marriage rites afta day, Amarachi say , “Peter no com get my number again.”

Nigeria police arrest Peter Nwachukwu ova di death of im wife.

FCT Police tok tok pesin DSP Josephine Adeh say dem dey run investigation.

Di arrest shele afta di broda of di late singer, file report to di police.

Wetin to sabi about Osinachi Nwachukwu

Di singer wey dey in her forties die on Friday for Abuja.

Before her death, Osinachi na singer, songwriter wey become very popular for her song Ekwueme wey be collaboration she do wit singer Prospa Ochimana.

Di hit gospel song get ova 71 million views for Youtube.

Osinachi don feature for songs like Nara Ekele by Pastor Paul Enenche and Ema You no dey use me play and also release new song wey she title God of all power.

She usually dey sing in di Igbo language wey people from Nigeria southeast dey speak.

Osinachi leave behind her husband and her four children.

Since her passing, many fans of gospel music dey send tributes as dem dey mourn Osinachi Nwachukwu.

Some pipo bin describe her voice as angelic and say e touch dem wella.